Ole Gunnar Solskjaer don collect confirmation as permanent manager of Manchester United

Ole Gunnar Solskjaer

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Solskjaer na di first United manager to win im first six league games

Manchester United on Thursday confam di appointment of Ole Gunnar Solskjaer as permanent manager for di club with three-year contract.

Solskjaer first be caretaker manager for di club afta e replace Jose Mourinho wey chop sack for December 2018.

"Dis na my dream job and belle sweet me well-well as I get di opportunity to lead di club for long," na wetin Solskjaer tok

"From di first day wen I arrive, I feel at home for dis special club. Na honour for me say I be Manchester United player before, and to start my coaching career here.

Di 45 year old spend 11 years as player for United, and na im score di winning goal for 1999 Champions League final.

Ole Gunnar Solskjaer

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ole Gunnar Solskjaer help Manchester United reach di quarter-finals of Champions League

"My experience dis last months dey fantastic." Di club manager add.

Wen dem appoint Solskjaer as caretaker manager for December, Man United dey sixth position for English Premier League and 11 points behind di top four.

Solskjaer na di first United manager to win im first six league games, im break Sir Matt Busby record.

Under im leadership, United reach di quarter-finals of di Champions League for di first time since 2014, afta dem knock out Paris St Germain for di round of 16.

Ole Gunnar Solskjaer record as Manchester United manager

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Ole Gunnar Solskaer win rate na 73.7% for all di competitions dem as United manager