AFCON 2019: CAF don give Egypt right to host dis year tournament

Egypt

Wia dis foto come from, Egypt FA

African football joinbodi CAF don give Egypt rights to host di 2019 tournament wey go hold for June.

Cameroon na dem bin suppose host am but CAF comot am from dia hand as dem no ready.

Egypt bin drag di rights wit South Africa, but Caf oga dem for Senegal vote to give am di north African kontri.