AWCON 2018 final: Nigeria Super Falcons beat South Africa Banyana Banyana to carri di cup

Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuper_Falcons
- Author, Olubunmi Okunnu
- Role, Broadcast Journalist, Lagos
Nigeria Super Falcons don win Women's Africa Cup of Nations for di number nine time afta dem beat South Africa Banyana Banyana for penalty shootout.
Nigeria las las win 4-3 on penalties afta Linda Motlhalo of South Africa play ball into di bottom left corner wey goalkeeper Tochukwu Oluehi block.
Defending champions Nigeria, wey before today neva lose any final for di history of AWCON, go feel say dem don revenge di 1-0 beating wey South Africa give dem for di group stage of di competition.
Di real shock of di match bin don come before for 74 minute wen Banyana Banyana goalkeeper Kaylin Swart chop yellow afta she foul one Nigeria player inside di penalty box.
Na di 2017 African Women Footballer of di Year winner Asisat Oshoala step up to take di penalty for wetin for don package di match give Super Falcons dia number 9 cup.
But she no score am.
By di end of full time for Accra Sports Stadium, Ghana, di score remain 0-0, so di Zambia referee Gladys Lengwe blow to carri di match enta extra time, wey still no produce any goal.

Wia dis foto come from, @NGSuper_Falcons
Nigeria start in a bad way for di penalty shootout afta defender Onome Ebi go hit post with di first penalty but Noko Matlou of South Africa score her own.
End of Di one wey oda users dey read well well
Banyana Banyana defender Lebohang Ramalepe come miss di second penalty as Nigeria score dia own.
Di two team score dia third penalty and Nigeria score dia fourth join but wen time come for South Africa to balance di score, Motlhalo miss to send Nigerians into jubilation.













