Ariana Grande, Taylor Swift, Justin Bieber, oda celebs wey dey use songs yab dia ex

5 music celebs wey don use dia songs yab dia former lovers

Wia dis foto come from, BBC/Getty Images

Ariana Grande bring out new song 'Thank you, Next' on Monday wey bin dey like say she dey throw shade give her former lovers.

She tok for Twitter say say she make sure dem hear am before she release am.

Pete Davidson and Ariana Grande

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di couple bin start to date for May and bin make dia first couple show for di 2018 MTV

Tori for town na say she dey tok about Pete Davidson and Mac Miller for di track. Di song belike reply afta di comedian use am joke again for im show, Saturday Night Live afta di break up.

But no be only Ariana Grande bin di star wey don yab her ex.

See celebs wey don shade dia ex for song

Selena Gomez and Justin Bieber dey kiss

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem off and on relationship finally scata for 2018

Selena Gomez - Same Old love take yab ex, Justin Bieber

Dis song na afta di first time wey Selena Gomez and Justin Bieber bin separate for 2012 fans come dey guess weda dem dey or no dey.

For 2014, Selena Gomez release "Same Old Love" wey she perform for di America Music Awards come tok say na di last time she wan tok about di mata but for 2016, dem come collabo again.

Entertainment

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Taylor Swift also dey popular for pesin wey sabi lank social media

Taylor Swift

E come be like say for 2015 di career of kontri-pop musician Taylor Swift shake small sake of broken heart or her former lovers.

Na why wen she release di Reputation ppipo begin dey chook eye inside to see weda anytin bin dey dia about her relationship with DJ Calvin Harris and actor Tom Hiddleston and she no disappoint for clear songs wey include Getaway Car and I did something Bad.

Ray J and Kim Kardashian

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ray J release dia sex tape

Ray J - I Hit It First to shade ex Kim Kardashian

Ray J recently enta news on top say e dey leak informate about how im sex life bin dey wit reality star Kim Kardashian West wen dem bin still dey around 2003.

But no be di only time e don cari Kim mata for im mouth, for 2013, shortly before Kim marry rapper Kanye West, e release "I Hit It First" wey pipo tok say dey about di current mother of three.

Taylor Swift and Calvin Harris

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, E no reach two weeks afta Calvin Harris confirm dia breakup wey she start dey kiss Tom Hiddleston

Calvin Harris - My Way to shade Taylor Swift

Many pipo bin dey vex for singer Taylor Swift afta she jump from her relationship with Calvin Harris enta anoda mata with Tom Hiddleston.

But e be like say Calvin Harris use di video of im 2016 "My Way" to clear im chest for di whole relationship

Justin Bieber

Wia dis foto come from, Getty Images

Justin Bieber - Love Yourself for Serena Gomez

For 2015 Justin Bieber release album - Purpose, many pipo comot tok say di whole songs for di album na about im former lover, Selena Gomez.

But none wey pass "Love Yourself" wey pipo tok say as di families of di two young singers bin no dey gel about dia relationship na wetin make Justin sing say "My mama don't like you and she like everyone".