Chelsea vs Man United: Why Jose Mourinho vex for Stamford Bridge

Jose Mourinho

Wia dis foto come from, Getty Images

Kasala bust for di technical area as Manchester United coach, Jose Mourinho, enta one trouser wit Chelsea officials afta im team draw 2-2 wit di Blues.

Di Red Devils bin dey lead 2-1 for Stamford Bridge for dia early Saturday match afta Anthony Martial score two goals to cancel di one wey German defender Antonio Rudiger first score for Chelsea.

Anthony Martial

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Man-U striker Anthony Martial don score for two back-to-back game now

But gbege start wen Chelsea technical assistant, Marco Ianni, run go di front of oga Mourinho to celebrate Barkley equalizer.

E even shake im hand for di Man-U coach face.

Na so oga Mourinho vex and charge afta di Chelsea official. Na stadium officials and Manchester United pipo hold am as e dey pursue oga Ianni.