Anthony Joshua don record im 22nd boxing victory wit Povetkin win

Anthony Joshua don beat Povetkin to retain im world heavyweight title belts

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigerian British boxer Anthony Joshua don use blow beat Alexander Povetkin for Wembley to keep im World Heavyweight title belt.

Povetkin wey bin dey hope to collect Joshua IBF, WBO and WBA titles no fit fight again afta round seven.

Joshua wey blood comot from im nose afta round one as Povetkin nack am beta punch recover to win im 21st professional fight by knockout.

Even though say Povetkin bin don lose only one match for im career to Vladimir Klitschko, di Russian suffer cut for im left eye for di fifth round.

Povetkin tested Joshua early on

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Joshua nose bin comot blood for di end of di first round after Povetkin nack am beta punch.

Afta di match finish for round seven as Povetkin fall fo rope, Joshua say e dey jolly say e don get im "winning streak back".

Joshua go fight again for Wembley on 13 April, but e neva know who im go fight.