Aretha Franklin, di 'Queen of Soul' don die at di age of 76

Read am in 2 mins

Ogbonge America singer Aretha Franklin don die at di age of 76.

For music and life, many pipo dey call her di 'Queen of Soul'

Franklin na one of di best soul singer for world for career wey begin around 1960s.

She bin don sick since 2010, wen dem find tumour for her bodi but she tanda for ground and even try to do some live performance afta she do surgery.

According to her staff Gwendolyn Quinn e be like na pancreatic cancer na im bin dey wori di music star.

Franklin, wey her voice na di ingredient to plenti music hits, na di first woman wey dem go honour for di music Rock n Roll Hall of Fame.

She sell pass 75m records for her life and win 18 Grammy awards.

She enta di US Billboard Hot 100 chart 77 times and get 20 numba 1 singles on di R&B chart - Her last album na A Brand New Me wey she drop for November 2017.

Her biggest songs na 'Say a Little Prayer' and 'Respect'.