Nicholas Bett: How former world champion die days afta e run for Asaba 2018

Bett die for car accident wey involve im motor for Nandi, north west Kenya

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bett die for car accident wey involve im motor for Nandi, north west Kenya
Read am in 1 mins

Kenya runner and former 400m hurdles world champion, Nicholas Bett die on Wednesday for di age of 28.

Di runner just return from di 2018 Africa Championships wey end on Sunday for Nigeria.

Athletics Kenya confam for Twitter say bett don die, while Kenyan sports minister Rashid Echesa tweet to send condolences give im family for di loss.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Nicholas Bett

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For 2015, Bett make history for China as di first Kenyan to win world gold for distance wey dey shorter than 800m.

Di motor wey Bett bin dey drive hit bump and rolled enta one pit around Sochoi area for Eldoret-Kapsabet road.

Bett be two-time African bronze medallist and im twin brother Haron Koech na also hurdler.