#TheBest FIFA Men’s Player 2018: Mbappe, Salah, Modric, Ronaldo dey drag di award

Wia dis foto come from, Twitter/@FIFAcom
World Cup winner Kylian Mbappe, Egypt forward Mohamed Salah and five time winner Cristian Ronaldo dey part of di shortlist wey world football goment FIFA announce for di Best Men Player award.
Brazil and Paris Saint Germain forward Neymar na one of di big names wey miss out from dis year nomination by FIFA.
Full shortlist
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
- Cristiano Ronaldo - Juventus & Portugal
- Kevin De Bruyne - Manchester City & Belgium
- Antoine Griezmann - Atletico Madrid & France
- Eden Hazard - Chelsea & Belgium
- Harry Kane - Tottenham & England
- Kylian Mbappe - Paris St-Germain & France
- Lionel Messi - Barcelona & Argentina
- Luka Modric - Real Madrid & Croatia
- Mohamed Salah - Liverpool & Egypt
- Raphael Varane - Real Madrid & France

Wia dis foto come from, Getty Images
Salah wey reach di final of di UEFA Champions League wit Liverpool dis year and win di highest goalscorer award for Premier League last season dey hope to win di award even though Egypt no do well for World Cup.
Mbappe wey win di World Cup wit France and also win di FIFA young Player Award for Russia go be di first teenager to win di award if im win am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
FIFA also announce dia shortlist for who go win di Coach of di Year award as dem list nine coaches wey include forma Real Madrid coach Zinedine Zidane and France World Cup coach Didier Deschamps.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
YOU DON SEE BBC SPECIAL VIDEO: Di film wey show as Nigeria football coach Salisu Yusuf: dey collect cash








