Transfer News: Sulley Muntari wan retire for Ghana Premier League plus Chelsea dey eye Ramsey

Wia dis foto come from, Getty Images
Forma AC Milan midfielder Sulley Muntari don reveal say im wan end im career for Ghana Premier League. (Goal)
Liverpool coach Jurgen Klopp dey sure say im top player Sadio Mane go soon sign new contract wit di club even though im still get three years wey remain for im contract. (Guardian)
Real Madrid no get any interest for Chelsea Brazil midfielder Willian but dem want Blues Belgium goalkeeper Thibaut Courtois. (Marca)
Chelsea dey do longer throat for Arsenal midfielder Aaron Ramsey wey neva sign new contract wit di gunners and dem believe say dem fit collect am wit £30million offer. (Telegraph)
Leicester City want still offload Algerian striker Islam Slimani permanently instead of to send am away on loan. (Leicestershirelive)
Bayern Munich midfielder Arturo Vidal dey about to port go Inter Milan on loan wit option say dem go buy am afta e expire. (Gazzetta dello Sport)
Monday transfer gist
Fulham don sign Serbia striker Aleksandar Mitrovic for undisclosed fee from fellow Premier League club Newcastle United.(BBC)
Bayern Munich coach Niko Kovac say 29-year-old Poland striker Robert Lewandowski wey Manchester United and Liverpool dey cut eye no dey go anywhere. (SkySports)
End of Di one wey oda users dey read well well
Swansea defender Alfie Mawson dey set to leave di championship club to join newly promoted Premier League club Fulham. (BBC)

Wia dis foto come from, iStock
Formal Chelsea midfielder Michael Essien don announce im retirement from international football ata ova 12 years of service wit Ghana. (Goal)
AC Milan dey ready to offer forma Chelsea oga Antonio Conte £5.5m-a-year deal to take ova from Gennaro Gattuso as manager. (Mirror)
Chelsea defender David Luiz wey im two legs no strong well -well for Stamford Bridge afta former manager Antonio Conte comot am from di first team say im wan win titles with di team. (INDEPENDENT)
Real Madrid midfielder Mateo Kovacic don tell im teammates say im go comot for di club for dis transfer window even though dem no ready to sell am. (AS)
Thomas Lemar say im dey "very happy with di decision" im make to join Atletico Madrid from Monaco, aft aim pass im medical to complete di move.(BBC)












