Mesut Ozil: Arsenal midfielder say im no wan play for Germany again

Wia dis foto come from, LUIS ACOSTA
Arsenal midfielder Mesut Ozil say im no wan play again for im kontri Germany.
Im release long statement wia im tok how di kain treatment im receive from di German Football Association (DFB) don make am "no longer want to wear di German national team shirt".
Im also claim say dem dey blame am for how Germany take disappoint for World Cup, wia e be say di defending champions no even see road pass group stage.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
For May dis year, dem give Ozil mouth wella afta im snap foto with Turkish president Recep Tayyip Erdogan for one London event.
Ozil attend di event with fellow Germany international Ilkay Gundogan. Both Ozil and Manchester City Gundogan get roots for Turkey.
Ozil say im and Gundogan tok about football with di president.

Wia dis foto come from, Getty Images
Many politicians begin ask kwesion weda Ozil and Gundogan dey loyal to Germany.
Germany bin don criticise as di Turkish leader take use strong hand stop pipo wey no agree wit am for im kontri, afta coup to remove am from office bin fail.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ozil say im for dey "disrespect im ancestors' roots" if to say im no snap foto wit di Turkish president.
Im add say im and im family don receive hate mail, wicked phone calls and some kain comments for social media.












