Mesut Ozil: 'I get two hearts, one German and one Turkish'

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin concern agbero wit overload, na popular tok for pidgin wey go dey footballer Mesut Ozil mind as im begin chop yabis say im snap foto wit Recep Tayyip Eerdogan.
Di Arsenal midfielder say e for dey "like im no respect im ancestors" if im bin no take photograph wit di Turkey presido, Recep Tayyip Eerdogan.
Ozil and Manchester City Ilkay Gundogan - both of dem wey get roots from Turkey chop yabis from di German Football Association sake of dem do meeting wit di presido.
For inside statement wey im post for twitter, Ozil say "no be about politics or elections" as im get "two hearts, one German and one Turkish".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
For di tweet Ozil tok say im no dey "forget wia im come from", but "im job na to be football player and not a politician".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Afta di players meet Erdogan for event for London wia Ozil say dem tok about football, dem take pictures wey Turkey ruling AK Party release days before elections for di kontri wey Erdogan win.
Many German politicians criticise Ozil and Gundoganuptill di point wia dem come dey question if dem dey loyal to German democratic values.






