You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
LeBron James to Lakers: How di god of LA take welcome di new King
Zlatan Ibrahimovic na footballer wey get mouth and anything im tok or do dey cari weight.
So wen Lebron James confam say im dey join Los Angeles Lakers wey dey di same city wia im dey play im football, trust Zlatan to chook mouth for di mata.
Zlatan enta twitter to welcome di new king of di West with dis tweet.
LeBron James sign four year contract with Lakers for $154m.
Di 33-year-old, wey don play for eight NBA finals, move from Cleveland Cavaliers.
Di former Manchester United player make fun with di transfer of di player wey many pipo dey call King James, come compare imself as god.
Social media catch fire with im tweet, e get plenty likes and retweets.
Na for March Zlatan move go California afta im struggle to recover from serious injury wey im get last season.
End of Di one wey oda users dey read well well