How Zlatan Ibrahimovich score fantastic goal for im first LA Galaxy match

I dey hear di crowd dey shout "We want Zlatan, we want Zlatan...so I give dem Zlatan."

Na wetin new LA Galaxy player Zlatan Ibrahimovich talk after e score equaliser goal from 35 yards come add another with header to help im team beat Los Angeles FC.

Di 36-year-old former Manchester United and Paris St-Germain striker say di way di crowd dey push na im make am give dem wetin dem want.

Ibrahimovich no start di match wey Los Angeles dey lead but dem e enta 20 minutes before di match finish.

Di ref give am yellow card because e remove im shirt to celebrate im first goal.

No be di first time di Sweden player don score for im first match for im new club.

E do di same tin wen e join Manchester United, Paris St-Germain, Malmo, Barcelona, Inter Milan and Juventus.

Ibrahimovich say "My history be say when I enta new team, I dey always score for di first game - I no wan fall hand for dis one."