England V Nigeria : Rohr don name 24 players for di friendly

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria coach Gernot Rohr don name 24 players wey go play England for international friendly match for 2, June.
Na for NFF official twitter handle im release di names of players afta dem meet with President Muhammadu Buhari and Senate President Bukola Saraki for Abuja.
Di 24 players na Daniel Akpeyi, Ikechukwu Ezenwa, Francis Uzoho, Abdullahi Shehu, Elderson Echiejile, Leon Balogun, William Ekong, Chidozie Awaziem, Ola Aina, Tyronne Ebuehi
Kenneth Omeruo, Bryan Idowu, Wilfred Ndidi, Mikel John Obi, Ogenyi Onazi, Oghenekaro Etebo, Mikel Agu, Joel Obi, John Ogu, Odion Ighalo, Simeon Nwankwo, Kelechi Iheanacho, Alex Iwobi and Ahmed Musa.
Di Super Eagles go train for Wembley Stadium on Friday ahead of dia match on Saturday
Dis na di third time di two kontris dey play each oda for football.
Di Nigeria team also confam say dem go check Moses Simon injury for UK to know how serious di injury be.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Getty Images
Analysis
Football analyst Ufuoma Egbamuno
End of Di one wey oda users dey read well well
Di players wey Gernot Rohr drop from di list no surprise me at all im go for experience and players wey go fit im style of play.
I feel say di player wey Rohr go drop from di 24 players na Ola Aina, di coach be tok say im no go wan carry plenty defenders go World Cup if you look di oda defenders wey dey di list I feel say na him di coach go drop for tactical reason.
A lot of fans and officials dey expect big- big things from dis team but for me I feel our first match against Croatia na im go determine how far di team go go.
Wen di draws comot and I see di teams di Super Eagles go play I feel say na third position wey go finish.
But with di World Cup anything fit happen. I feel say di group wey we dey no easy at all.










