AFCON U-20 Niger 2019: Cameroon beat Uganda 5-4 for go next round

- Author, Leocadia Bongben
- Role, BBC News Pidgin, Cameroon
Cameroon U-20 don qualify for next round for Africa Nation Cup, Niger 2019. Na through penalties 5-4 for match weh deh play for Ahmadou Ahidjo Stadium.
For de first leg, Uganda bin win de U-20 Lions 1-0.
Den for rerun match, Nkeng Fomakwang Taddeus score penalty for 67th minute.
But Cameroon miss some goal weh e for make den win directly.
As de two teams dem get one goal each deh go for penalties.
Cameroon coach, Christophe Ousmanou say na only second real match de team play and win Uganda under hard struggle.
Even if deh win deh go continue for train and also wait for professional players.
Cameroon go meet de winner match Tanzania/Malawi for next round.
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading
Di one wey oda users dey read well well
End of Di one wey oda users dey read well well











