You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Man City v Liverpool: Wetin go happen for Etihad Stadium?
For di second time in one week, Liverpool and Manchester City go face each other again for Champions League quarter-finals.
Liverpool win di first leg 3-0 for Anfield with goals from Mohammed Salah, Alex-Oxlade Chamberlain and Sadio Mane.
E mean say, for dis match wey go happen for Etihad Stadium, City must score three goals and make sure say di Reds no score to carry di match go extra-time.
But wetin go happen for Etihad?
Sergio Agüero fit start for City?
Aguero miss di first-leg for Anfield last week because of injury but im play against Manchester United for di Manchester derby wey City loose.
Di forward na di club highest goal scorer with 30 goals dis season for all competition.
Klopp fit pour sand for Guardiola mouth again?
Di two managers like to play attacking football but Klopp get upper hand because e don beat Guardiola two times already dis season.
End of Di one wey oda users dey read well well
To equalise one goal for Champions League no easy, not to tok of three. So pipo dey wonder how Man City go do am.