Roger Federer don beat Robin Haase to become di oldest world number one

Roger Federer with trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Federer on top social media say Im just happy to return to number, and to dey in good health to play tennis
Read am in 1 mins

Roger Federer on top di mata say im don become di world number one wey old pass for tennis history - 14 years after im first reach di position - say na "dream come true" for am.

Di 36-year-old beat Robin Haase 4-6 6-1 6-1 for di last eight of di Rotterdam Open to replace Rafael Nadal, 31, for di top of tennis ranking.

List of oldest players wey don reach number one for tennis
Wetin we call dis foto, Na 2050 days since Federer don dey number 1 last for tennis

Federer now don pass Andre Agassi, wey don win Grand Slam eight times, wey hold di record before as oldest number one at 33.

"Dis one dey very important to me at age 36, almost 37," talk di Swiss champion.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

When you don old, you need to work double wetin you dey do before. You need to fight to win against person wey don work hard to reach where im dey.

To reach number one na di biggest achievement for tennis. Na amazing journey and to do am for here, where I bin first get my wildcard for 1998, mean a lot to."