Winter Olympics 2018: See Africans wey dey compete for Pyeongchang

Na eight African countries go show for di 2018 Winter Olympics for Pyeongchang, South Korea, wey go start on Friday 9 February.

As e be say we no get snow and we get one of di hottest continent for di world, Africa no get di weather for dis winter sports dem, like skiing, bobsleigh and snowboarding.

But even wit all dis things dem wey no favour us, sports people from African country dem like (Nigeria, Eritrea, Ghana, Kenya, Madagascar. South Africa, Morocco and Togo) go represent us for Pyeonchang 2018

Dis na di first time wey e go happen for country dem like Nigeria and Eritrea, wey dey show for di first time for any Winter Olympics.