Pierre-Emerick Aubameyang: Arsenal fit comot up to $84m for di Borussia Dortmund striker

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal don dey close to make agreement final to sign Gabon striker Pierre-Emerick Aubameyang from Borussia Dortmund for about $84m.
But di transfer no go dey official until Dortmund don see player wey dem go take replace Aubameyang, even as dem dey consider Olivier Giroud of Arsenal, according to some reports.
Dortmund don already reject two bids wey Arsenal make for di 28-year-old.
Aubameyang bin play on Saturday inside 2-2 draw with Freiburg - di first time im go start game for di German club since 16 December.
Dortmund say dem ready to sell di 2017 BBC African Footballer of di Year finalist when "dem don agree fully to some things".
Di Bundesliga club turn back di bid of 50m Euros ($61m) from Arsenal on Wednesday.
But many Arsenal fans don tire to dey wait for Aubameyang to enter Emirates as dem dey hope to get mouth for Champions League qualification dis season.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Arsenal dey expect to carry Aubameyang come to take replace Chile forward Alexis Sanchez, wey join Manchester United dis month inside swap deal with midfielder Henrikh Mkhitaryan.
End of Di one wey oda users dey read well well












