Big boys win dia opening Champions League matches

Wia dis foto come from, SNS
Paris Saint-Germain, Barcelona, Bayern Munich, Manchester United and Chelsea win dia opening match for di 2017/2018 Champions League campaign on Tuesday.
All of dem shine for dia group with very good results.
PSG 5-0 flogging of Celtic for Scotland na one of di standout result and performance on di night.
For Spain Barcelona beat Juventus 3-0 for Camp Nou. Messi score two goals.
Di English clubs no disappoint dia fans too, as Chelsea thrash Qarabag FK 6-0 while Manchester United score 3-0 against Basle.
Na only AS Roma and Atletico Madrid match wey no score goals

Wia dis foto come from, SNS
Other results
•Olympiakos 2-3 Sporting Lisbon
End of Di one wey oda users dey read well well
•AS Roma 0-0 Atletico Madrid
•Bayern Munich 3-0 Anderlecht
•Benfica 1-2 CSKA Moscow










