2018 World Cup: Why Ghana no sure of qualification

Two players wey dey tackle each other

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ghana and Congo wey just play dis weekend don meet before for Africa Cup of Nations quarter finals for January

BBC News Pidgin sabi person for sport, Fiona Equere, don talk say Ghana World Cup qualification no dey dia hand again.

Dis na as di Black Stars draw one-one against Leopards of Congo wey dem play for home for Kumasi on September 1.

Thievy Bifouma score for Congo and Thomas Partey equalise for Ghana inside second half.

Ghana dey third position for dia Group E World Cup Qualifiers.

Di group get Uganda for number one position with 7 points, Egypt come follow with 6 points and Ghana dey far with two points.

Equere say "Ghana go need nine more points to qualify for di Russia 2018 World Cup. But as na only two matches remain for dem to play for di qualifiers; e go hard for dem to meet up."

She say dis na because na only di team wey dey di top of di table with 11 points go qualify for di 2018 World Cup.

Dat one mean say, even if Ghana win dia two matches wey remain and collect six points, e no go reach because dem still need three more points to qualify.

Congolese team dey pray

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, The Congolese team dey the bootom of di World Cup Qualifiers Group E

Ghana and Cameroon dey for inside di same boat because Cameroun sef, na two points dey dem pocket as Nigeria beat dem for dia last match.

Fans dey talk for social media

Tweets wey dey about di Match

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, "I happy for Thomas wey score im first international goal however, i remember when i dey watch am live for Mallorca."
Twwets from the game

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, "No forget say Ghana cheat to get one point against Uganda. And yesterday na luck dem use get one point against Congo."
Tweets from di game

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, "I go talk am again. Make Ghana dey spend more money on top boxing and athletics."
Tweets about di match

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, "Hmm Ghanians get more interest for di Egypt vs Uganda match pass Ghana vs Congo... e dey sad for GH football."