Police don charge Wayne Rooney for drink-driving

Wia dis foto come from, Getty Images
Police for Cheshire, United Kingdom don arrest, then charge Everton striker Wayne Rooney; dem say im drink plenty alcohol finish, come begin drive up and down for road.
Dem arrest di ex-England captain just after 02:00 British Standard Time(BST), on Friday, after officers stop one black VW beetle motor for Altrincham Road, Wilmslow.
Di accusation bi say Rooney drink pass di limit wey law allow.
Police release Rooney on bail and im go appear for Stockport Magistrate Court, later dis month.

Wia dis foto come from, BBC Sport
Rooney wey be 31 years old, announce say e go retire for international football last month, after 53 goals for im country for about 119 appearances.
He rejoin im former club - Everton during this summer, 13 years after e bin leave Merseyside go Manchester United.
Wetin be Drink-driving law?
Dilaw be say, any person wey dey drive motor no go drive pass di limit of alcohol wey government don put for ground.
End of Di one wey oda users dey read well well
This na how dem take dey measure am:
Micrograms per 100 millilitres of breath35
Milligrammes per 100 millilitres of blood80
Milligrammes per 100 millilitres of urine107
Di drink-drive law na part of UK government campaign to make people dey more careful for road when dem dey drive so dat dem no go harm demself, and other people wey dey waka with leg for road.
Punishment for Drink-Driving
For United Kingdom if police catch person for drink-driving, court fit send am to prison, ban am from driving or na to pay money as fine.
Na di magistrates wey hear each case, go fit decide di real penalty and dis one depend on di offence.
Sometimes, dem fit reduce person ban, if e do drink-drive rehabilitation scheme course.










