Fuel Scarcity in Lagos today: NMDPRA confam say bad fuel bin dey in circulation for di kontri

Di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA) don confam say petrol wey get methanol inside bin dey di kontri.

Di agency on Tuesday for statement say true-true di petrol wey get methanol quantities above Nigeria specification dey inside di supply chain but e dey limited.

Di goment agency say dem don separate di bad product and don withdraw am from market.

Suspicion from Nigerians bin don comot online earlier in di day as some share videos of di kind fuel wey dem buy while odas claim say dia vehicles don pack up due to di bad fuel.

Long queues bin dey sighted for some petrol stations for Nigeria capital, Abuja and commercial city, Lagos as pipo gada to buy both in gallons and for dia motor.

Dis contaminated fuel na im bin cause di queues as filing stations bin no dey open and some of dem wey open bin complain of poor supply.

Di NMDPRA say, "Our technical team in conjunction wit NNPC Ltd and oda industry stakeholders, go continue to monitor and ensure say we supply and distribute quality petroleum products nationwide.

"We don identify di source supplier and further commercial and di Authority and NNPC Ltd go take appropriate actions."

Wetin cause di fuel scarcity

Di National Operations Comptroller, Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN) Mike Osatuyi don explain di reason for di fuel scarcity.

E tok say goment import bad fuel wey fit spoil motor.

"Di issue be say di fuel wey goment bring in na off-spec, dat is e dey contaminated somehow, e no dey good for vehicles to use sake of say e go knock down, I dey sure say dem don withdraw am right from di market," oga Osatuyi tok.

"You know say e go take sometime before dem go fit go bring anoda beta fuel come becos of logistics.

"If you bring fuel wey fit last you for one month and you come find out say dem no go fit use di fuel, before you put di process to replace am and di capital (money) wey dey involve e go take sometime.

"Make Nigeria bear wit goment, e don tey wey we don hear about dis contaminated fuel for di kontri, na di truth be dat"

"No loading for Depot, dis na becos goment na di only importer, so di one wey dem bring wey dem suppose share give marketers dem no fit share am sake of say e no good" e tok

E explain say im sef neva load for some days now sake of wetin dey happen.

"Na from dia we sef go load, as I dey tok now I neva load for di past 3-5 days becos no depot dey load.

"Like say some oda importers dey e for bridge di gap.

"Becos of di subsidy regime nobody go bring in fuel for Three Hundred and Ninety naira to Four Hundred naira come sell am for One Hundred and Sixty-Two naira."

Wetin be subsidy and how e take affect Nigeria economy?

Fuel subsidy be sometin wey dem dey call under-recovery and na im be di under-priced sales of petrol.

Di official reason for oil subsidies na to reduce di impact of rising global oil prices on Nigerians.

Fuel subsidy don dey di kontri since di 1970s.

Dem institutionalise am for 1977, under di regime of General Olusegun Obasanjo wit di promulgation of di Price Control Act wey make am illegal for some products (including petrol) to dey sold above di regulated price.

Between 2006-2018 Nigeria spend about 10 trillion Naira on petroleum subsidies.

Federal goment suspend plan to remove subsidy

Nigeria Minister of Finance, Budget and National Planning, Zainab Ahmed say goment don march break on top im plan to remove fuel subsidy for di kontri.

Di Minister tok say di suspension na till further notice during one ogbonge meeting wit legislators for inside di National Assembly for Abuja, di Nigerian capital.

She further explain give say afta dem look inside di timing of di fuel subsidy removal and di fact say in flation for di kon tri dey high, di president Muhammadu Buhari come reason am say di whole tin go cause plenti hardship for ordinary Nigerians and di president no like dat kain tin.

She further explain give say for di 2022 budget, dem be make provision for fuel subsidy from January to June and dat na from July na im subsidy for no dey.

she further explain give say dem go continue to hold discussion wit different actors to ensure say dem dem rehabilitate di four national refin series wey get capacity to refine 450 000 barrels of of crude oil per day-as e go reduce di importation of petrol to di kontri.