Reckya Madougou: Benin female opposition leader get 20 years prison sentence for terrorism

Reckya Madougou, Benin Republic female opposition leader on Saturday get a 20-year prison sentence.
Di Economic Crime and Terrorism Court sentence di first eva female presidential candidate for a major party for terrorism.
Madougou na di leader of di kontri biggest opposition party and she bin contest di April presidential election under di "Democrats" Party.
Na early mor-mor on Saturday di sentence di former Minister of Justice to 20 years in prison.
Di judgement bin happun by 5am for Porto Novo wey be di political capital of Benin.

Wia dis foto come from, Reckya Madougou/ Facebook
Di 47 year old politician bin go on trial and bin plead not guilty for di terrorism charge. E take di court 20 hours to hear di case.
Reckya Madougou bin tok before dem announce her sentence say, "dis court don decide say dem go imprison innocent woman, I bin neva and no go ever be terrorist."
So far, Madougou no go be di first pesin to chop dis kain charge as di court bin sentence anoda key opposition figure to 10 years imprisonment on Tuesday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Since 2016, many opposition leaders don go exile or dey banned for running for office for Benin. Dis one dey come as critics dey dey tok say di kontri don dey waka enta authoritarianism under President Parice Talon.
Wetin make dem nack Madougou wit terrorism charge?
Ms Madougou bin face accuse say she try to scata election and destabilise di kontri.
Di Benin opposition leader appear for di kontri Economic Crime and Terrorism Court on charges of financing terrorism.
Before dem sentence am, dem bin detain di former justice minister for more dan eight months.
She be di leader of Benin largest opposition party - the Democrats - and bin dey hope to be di first female presidential candidate to come from a major party.
But dem reject her candidacy for di presidential election wey hapun for April dis year.
Her lawyers and supporters say di trial dey political.
Goment officials dismiss claims of political interference and say Benin judiciary dey independent.
Dem sentence anoda opposition figure, Joël Aïvo, to 10 years in prison on Monday.













