Gambia presidential election results: Adama Barrow win 2021 re-election, opposition reject

Gambia presidential elections results: President Adama Barrow win 2021 re-election

Wia dis foto come from, Reuters

Adama Barrow don win Gambia presidential election, IEC don declare.

Di results Independent Electoral Commission declare on Sunday night mean say Barrow don secure second term of anoda five years for office.

Dis go be di first election in 22 years wey no get long term leader of di kontri, Yahya Jammeh.

President Barrow bin gbab 53% of di Saturday 4 December, 2021 vote.

While di pesin wey come second, Ousainou Darboe, wey be lawyer get 28%.

Oga Darboe and oda candidates say dem no dey accept di results of di poll because kukere dey inside.

Who be Adama Barrow?

Gambia presidential elections results: President Adama Barrow win 2021 re-election

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Adama Barrow

Adama Barrow na successful property developer wey bin neva run for office before im win im first presidential election for 2017 wen e beat Yahya Jammeh to become president.

Di 55 year old bin work for 10 years for property before im come open im real estate company for 2006.

For di early 2000s, e bin dey live for di United Kingdom for plenti years and tori be say e bin dey work as security man for Argos catalogue store for north London as e bin dey study real estate.

Infact, as at dat time, British media bin tok say oga Barrow as im dey work as security man bin gbab pesin wey dey tiff un der wetin dem call citizen arrest.

Oga Barrow na die hard Arsenal fan sotay wen dem dey count im result wey e win Yahya Jammeh for 2017, oga bin dey hail di club for social media.

Wetin be kasala wey fit burst for Barrow with dis second term

The Gambia na one of di poorest kontri for di world with im 2.4 miillion population.

Di main stay of dia economy na tourism but di coronavirus pandemic scata am, dat na one of di tins wey come up during campaign.

Oda than that, unemployment and weda dem suppose allow oga Jammeh enta kontri from im exile na tins wey dey pipo mind as Barrow dey start im second term.