Meet de 9-year-old wonder girl who dey repair motorbikes

Wetin we call dis Video, Meet de 9-year-old wonder girl who dey repair motorbikes

Meet nine-year-old Susanna Adjarkei Apperkon wey be experienced motor-bike repairer wey get plans to open her own auto mechanic shop.

By age three, she already develop interest in motorbikes, start dey learn de job wey she repair her first motorbike around age six.

Susanna now turn professional motorbike repairer, she talk BBC Pidgin say "at my age I go fit teach anyone how to repair motorbikes."

Video by: Ufuoma Gift