Grace Wanja: Di 13 years old girl wey dey ginger pipo wit her acrobatic skills
"I wan make my dream take me far, like to see American Presido Donald trump."
Na so 13 year old Grace Wanja wey be acrobat wit big dream to perform for world stage tell BBC News Pidgin.
Grace say she dey always waka round di streets and markets of Kenya dey perform for money to take assist her single mother take care of di house.
She learn how to do acrobatics from internet and she want make di whole world see wetin she fit do.
Di 13 years old girl get dream to also perform for Kenya presido Uhuru Kenyatta and Simon cowell for America's Got Talent.
Video Journalist: Sarah Tiamiyu

