Cameroon vs Ivory Coast live stream: Toko Ekambi give Indomitable Lions 1-0 victory over Elephants

Wia dis foto come from, Getty Images
Cameroon don qualify for di playoff round to reach Qatar 2022 World Cup.
Karl Toko Ekambi first half goal na im help di Indomitable Lions to important victory over Ivory Coast wey bin dey top di group.
Ekambi control pass from Martin Hongla before im waya shot wey beat di goalkeeper.
Cameroon dominate di match but bin really need di win to ensure say dem dey part of di 10 teams wey make di playoff round.
Dis go be di second straight World Cup wey Ivory Coast no go qualify for.
Dem go need ask demsefs some questions as dem top di group all through before dis last group match with Cameroon.
Wit di victory, Cameroon finish top of di group wit 15 points wile Ivory Coast get 13 points.
Di win see Cameroon join Senegal, Algeria, Egypt, Mali, Ghana, Morocco, Nigeria, Tunisia and DR Congo as kontris wey qualify for di playoff round.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na only five of dis teams out of ten go qualify for Qatar 2022 World Cup.
First half

Wia dis foto come from, Getty Images
Di teams don sing dia national anthems finish and don dey set for kickoff.
1min - Di host take di first touch as dis crucial qualifier don start.
3mins - Cameroon Leftback Nouhou Tolo don pick up injury and no go fit continue.
5mins - Ivory Cpast win freekick just outside di area as Cameroon foul Gradel.
6mins - Olivier Mbaizo don replace Tolo. Meanwhile Gradel kick di freekick go over.
11mins - Di hosts don begin enjoy good amount of possession but never create clear-cut chance yet.
15mins - Good buildup play see Aboubakar shoot weak shot wey im no hit well. Easy catch for Gbohoou.
21mins - Goal!!! Karl Toko-Ekambi give Cameroon di lead. Di Lyon forward control Martin Hongla pass before im fire di shot past Gbohouo inside di 18-yard box.
32mins - Zambo Anguissa foul Gradel just close to di corner flag. Seri to take, Boly head di cross over.
33mins - Save! Onana deny Frank Kessie from close range.
34mins - Yellow card! Cameroon hope to start counter-attack but Seri bring down Aboubakar.
40mins - Save! Aboubakar test Gbohouo from outside di box. Di goalkeeper push am go out for corner wey dem later clear.
45mins - Zambo Anguissa head cornerkick well wide. Cameroon still look comfortable so far as dem lead 1-0.
45+1min - Hongla spin loose im marker come pass give Ngamaleu wey bin dey 1-on-1 wit Bailly, di defender block im shot. From di corner Gbohuo clear di ball.
Half Time - Cameroon 1-0 Ivory Coast. As e stand na Cameroon go top di group.
Second half
Ivory Coast make change, Ibrahim Sangare enter for Odilon Koussounou.
53mins - Onana replace Hongla for Cameroon. Still 1-0.
58mins - Referee give Mbaizo yellow car togeda wit Frank Boli.
60mins - As e stand wit Cameroon lead, Ivory Coast go miss out from Qatar 2022.
69mins - Ivory Coast make two substitutions; Seri and Kouassi OFF, Pepe and Traore ON
71mins - Ekambi, Ngamaleu and Aboubakar leave di pitch, Choup-Moting, Lea Siliki and Tawamba enter.
81mins - Cameroon try to break quickly, Choupo-Moting try to chip Gbohouo but e go over.
83mins - Another change for Ivory Coast: Christian Kouame come on for Gradel.
85mins - Kessie connect wit Pepe cross, Onana catch im header am well.
89mins - Home fans for di Ahmadou Ahidjo stadium for Yaoundé don begin celebrate, just one minute before injury time. Referee add four extra minutes.
90+2mins - Chance! Kouame blast half chance ova di Yaoundé sky.
90+3mins - Cameroon goalkeepr Onana collect yellow card for time wasting.
90+4mins Last chance for Ivory Coast, Pepe to take corner wey even di goalkeeper rush come to no but Cameroon clear am. Di referee blow di final whistle.
Cameroon progress, Ivory Coast crash out and go miss dia second straight World Cup. E finish Cameroon 1-0 Ivory Coast.
Cameroon lineup: 23. Onana, 19. Fai, 22. Onguene, 3. Moumi Ngamaleu, 5. Ngadeu-Ngadjui, 4. Tolo, 14. Gouet, 18. Hongla, 8. Anguissa, 7. Toko Ekambi, 10. Aboubakar.
Ivory Coast lineup: 16. Gbohouo, 7. Kossounou, 21. Bailly, 6. Boly, 17. Aurier, 8. Kessie, 4. Seri, 11. Cornet, 10. Kouassi, 22. Haller, 15. Gradel.













