Joeboy New Album: Wetin we know about Somewhere Between Beauty and Magic

Wia dis foto come from, Facebook/ Joeboy
Joe boy don drop im first studio album, Somewhere Between Beauty and Magic on Thursday, 4th February.
E go be im first full bodi of work since im EP wey im bring call am Love & Light.
Joeboy post to thank im fans as dem hype di album as e comot.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di 14 track album no feature any oda artists and follow im normal M.O of im songs wey normally dey short but tori be say di songs average long pass im EP.
Many pipo don dey gbadun di song for inside social media, as one pesin to say di reason why im no call di song "Somewhere Between Beauty and Pure Juju" im no go too cast.

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Joeboy

Wia dis foto come from, Faith Oshoko

Wia dis foto come from, Twitter
E bin reveal wen im drop tracklist for di begining of February say, "To create records dem wey dey live changing na one of life's greatest gifts to humanity, and I don live inside di music sotay "
Wetin pipo dey tok about di album?
Plenti pipo don gbadun di song for inside social media sotay e start to dey trend for inside social media.
Some pipo don either pick "Door" or "Show Me" as dia favourite song for di album.
End of Di one wey oda users dey read well well
While odas dey tok about im bin no feature for im album.
Who be Joeboy?
Joeboy, na di first artist wey comot from emPawa Africa and for 2019, release di visualizer for im first hit wey im call "Baby".
Di 23 year old come drop im EP dat same year wey im call Love & Light wey feature songs like Beginning, Don't Call Me Back and All For You.
Joeboy bin tease say im go drop im first studio album by 2020 but im postpone am.
For 2019, im bin also reveal for BBC Pidgin QTMPY say im bin already get babe.













