You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Coronavirus Nigeria: Many travellers dey import Covid-19 enta Nigeria
Nigerians in Diaspora Commission say many travellers wey dey enta Nigeria dey test positive to Covid-19 afta seven day isolation, even though dem bin test negative before begin dia journey.
Di commission say out of 2,403 passengers wey dem don test for Lagos alone since dem begin Covid-19 PCR testing exercise, 80 of dem test positive to di virus.
Recent report from World Health Organisation Covid-19 for Africa show say di number of infections don reduce by 13%.
But di Diaspora commission don draw ear say, even though e be like say di spread dey reduce, some kontris dey experience second and third wave and "di risk of importing di virus enta Nigeria dey real.
"We must do everitin we fit to reduce di risk of transmission from passengers wey dey enta di kontri by testing, identifying positive cases, and isolate dem to reduce spread."
For now, Nigeria airports neva dey operate for full capacity, but dey commission say dem fit no detect many cases wen dem begin operate full capacity wit 5,000 passengers everyday.