Covid-19: Coronavirus deaths don pass one million for di world, see wia di outbreak hit di most

Coronavirus now don contribute to di deaths of one million pipo worldwide.

Di reports of di millionth death arrive just short of 10 months afta dem confam di first death for China, in January.

Di virus continue to dey spread across di world, with more dan 33 million confam cases in 188 kontries.

Di virus dey rise for many regions and some kontries wey dey successful in fighting di first outbreaks don again dey record rise in infection rates again.

Wia di cases and deaths dey rise?

Di World Health Organization (WHO) don warn say di death toll fit hit two million before effective vaccine go show.

Some regions don see new coronavirus cases rise over di last few months, with India dey lead numbers for Asia.

Di official number of confam infections for India don reach six million, di second-highest in di world afta di US.

How confam cases of coronavirus don spread

Goments across di world don dey forced to limit public movement and close businesses and venues to slow di spread of di virus. Dis wna don affect di global economy well-well.

Di damage to di world major economies dem dey four times worse dan di 2009 global financial crisis, according to di Organization for Economic Cooperation and Development (OECD).

Meanwhile, di United Nations say up to 265 million people fit face starvation by di end of di year because of di impact of Covid-19.