You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
FA Cup final Arsenal vs Chelsea: Arsenal beat Chelsea to win di FA Cup for di 14th time
Arsenal don beat Chelsea to win di FA Cup for di 14th time wit 2 goals.
Di match end with 2-1 against Chelsea wey get 10 players for di team.
Pierre-Emerick Aubameyang na im be di hero for dis match as e score di penalty wey cancel di goal wey Chelsea Christian Pulisic bin score 30 minutes into di match.
Aubameyang come score another goal for di second half to beat Chelsea 2-1 and win di FA Cup for a record of 14 time for Wembley stadium.
Di Blues lost three players to injury and dem pursue Kovacic before di match end.
Chelsea lost captain Cesar Azpilicueta and Pulisic to hamstring injuries.
Chelsea bin collect yellow card for di first half, dey also collect anoda one as di second half start.
Arsenal Manager, Mikel Arteta tok say im dey proud to represent di players and di club. He say di players use dia mind play di match and im dey very happy for dem.
End of Di one wey oda users dey read well well
Arsenal now don qualify for di Europa League.
Many Arsenal fans for Nigeria don enta social media to express dia joy for dis ogbonge win.