AFCON 2019: Gambia petition Caf say Togo dey use Nigerian play qualifier

Wia dis foto come from, Togo Football Federation
Gambia Football Federation write petition to Confederation of African Football (Caf) against Togo on Thursday say dem use player wey no from dia kontri play AFCON qualifier match.
Dem say Togo player Adewale Olufade no qualify to play for 'Di Sparrowhawks' wen di team play 1-1 draw wit 'Di Scorpions' on October 12 .
Gambia Football Federation - GFF dey protest say Olufade na Nigerian im be and e no qualify to play for Togo.
Di GFF for letter to Caf tok say even di way Togo spell di player name for dia team sheet get as e be as for di matchform, dem write "Adewale Oloufade but for Caf system dem register am as James Adewale Olufade."
Wetin players need to play for anoda kontri
Under Fifa law, if any player wan play for anoda national team im need to fulfil dis criteria:
- Dem born di player for di territory of di association e wan play for.
- If dem born im mama or papa for di territory of di association e want play for.
- Dem born im grandpapa or grandmama for di territory of di association e want play for.
- If di player don kontinu to live for at least five years afta im reach di age of 18 for di territory of di kontri im want play for.








