Kofi Annan do im best to win for Africa - Emeka Anyaoku
Ghana dey bury di former UN Secretary-General, Kofi Annan, and many leaders still dey troway accolades give am.
Former Commonwealth Secretary-General, Emeka Anyaoku, say im be padi-padi wit oga Annan for over fifty years and e know say e fit for di common man al ova di world.
E tok say di late Annan na pesin wey fight well-well to raise di wey pipo dey look Africa.
Tori be say Annan bin sick afta im return from South Africa to celebrate di 100 year anniversary of freedom fighter and former presido Nelson Mandela birthday.
Kofi Annan, di gentle peacemaker, wey bi di seventh and only black African UN Secretary General die for 18 August dis year for Bern, Switzerland capital afta short sickness.
Ghana bin announce say na for Burma Camp military cemetery for Accra, di headquarters of Ghana Armed Forces dem go bury am.
Di new military cemetery na wia Ghana dey bury military officers, presidents and ogbonge citizens wey don cari Ghana reach anoda level.




