Former UN Secretary General Kofi Annan don die

Kofi Annan, UN Secretary General

Wia dis foto come from, Adam Berry/Getty

Read am in 1 mins

Kofi Annan wey be former United Nations Secretary General wey win di Nobel Peace Prize for humanitarian work don die at di age of 80.

Di Ghanaian diplomat, Annan na di first black African wey take di work of Secretary General for UN and im serve for two terms. Dat na between 1997 to 2006.

Deputy Foreign Affairs Minister for Ghana Charles Owiredu confirm di news give BBC, he talk say e be very sad to lose a stateman like Kofi Annan.

Di Annan family and Kofi Annan Foundation na im announce say, "im pass away peacefully on Saturday 18th August afta small sickness." Im die for Switzerland Saturday morning.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Kofi Annan bin be ogbonge international state man wey fight for peace and fairness throughout im life.

E later become part of UN envoy for Syria wey bin dey find way for peace to dey for di kontri.

World leaders don dey already tok on top im death for social media.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Current Secretary General Antoni Gueterres, praise am say im be guiding force for good and e bin dey as inspiration for future generation.