Anambra governorship election live updates as e hapun

Dis na di live coverage of di 2025 governorship election for Anambra state, South east Nigeria

Summary

Live Coverage

Victor Ezeama and Adesola Ikulajulo

  1. Una bye bye for now!

    We go match break for now ontop our coverage of di Anambra State govnorship election.

    Citizens don vote and dey await results.

    Na 16 candidates in total contest for di polls, but sabi pipo say na four of dem be di main contenders.

    Na Inec, di kontri election join bodi go announce di result as soon as e begin land from di 21 local govment areas dem.

    You fit scroll down to catch up on how di election waka today.

  2. When Inec go announce di result?

    Two electoral officers dey collate result from one polling unit

    Inec no tok specifically how long e go take to announce di winner for dis election process.

    But for di last election for 2021 e take three days for Inec to announce am.

    Anambra State get 21 LGAs and Inec don say di whole tin dey follow a process.

    Di electoral process dey start from accreditation of voters, voting, counting, collation and results declaration and all dis process dey follow themselves.

    Di Presiding Officers go send di results from di poll to di RA Collation Officer. Di RA Collation Officer go collate and send di result to LGA Collation Officer.

    Di LGA Collation Officer go collate di results and send to di State Returning Officer.

    Di State Returning Officer go collate results from LGA Collation Centres, declare di result and return di winner as governor elect for di state.

    BBC News Pidgin go dey update wit di latest as soon as Inec begin announce di results.

    You go fit follow am hia: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjw98zpl2j7o

  3. Vote buying, voter apathy threaten Anambra govnorship election,

    Electorate gada to vote for di Anambra state govnorship election

    Di govnorship election for Anambra State, southeast Nigeria hapun dis Saturday, and BBC News Pidgin bin dey on ground to report how tins take waka.

    Anoda of our tori pesin notice say Inec workers come out on time for majority of di local govments and voting start early. We also notice say di Biometric Voter Accreditation System (BVAS) work well for many of di polling units as pipo no too complain about accreditation and voting.

    But, di turnout of voters no too dey impressive.

    For some of di polling units, Inec workers just dey chill as dem dey wait make voters come out, but for some oda polling units di number try.

    Sorting and counting of votes start by exactly 2.30pm and before half past three, many polling unit results don ready and pipo don dey download am from di Inec Result Viewing Portal (Irev).

    As for security, evriwia dey peaceful.

    No report of violence for di places wey BBC News Pidgin bin monitor and so far, we neva get report of katakata for aniwia.

    All eyes now go dey for di state collation center for di Inec headquarters, wia di returning officer go call di final result and announce who go be di guvnor of Anambra State for di next four years.

  4. Wetin be di next step as voting end?

    Foto of how di vote counting and sorting dey hapun for Anambra election
    Wetin we call dis foto, Foto of how di vote counting and sorting dey hapun for Anambra election

    Collation and declaration of results na di next step afta voting end and na dem be critical stages for di election process.

    Collation na di process of putting togeda di votes dem cast for di election, to tabulate am and sum am up.

    While di final step for di election process na di announcement and declaration of results. Na electoral officials, Inec dey do dis one.

    Na different levels of collation dey.

    • Di Presiding Officers go send results of poll to di Registration Area/Ward level Collation Officer;
    • RA Collation Officer go collate and send result to LGA Collation Officer;
    • LGA Collation Officer go collate results and send to State Returning Officer;
    • State Returning Officer go come collate results from LGA Collation Centres and declare di result and return di winner as Govnor elect for di State.
  5. 'Anambra govnorship election witness low voter turn-out, vote buying',

    Pictures from Anambra wia vote counting dey go on as voting end
    Wetin we call dis foto, Fotos of how di vote counting dey happun

    Voting don end for plenti polling units across Anambra state as pipo comot to vote who go be dia next govnor.

    For about 20 polling units wey BBC News Pidgin visit as at di time of dis report, Inec officials dey sort votes while odas dey count di votes.

    Some don complete vote counting and paste dia results for wall. Di election witness low turnout of voter for plenti polling units wey BBC News Pidgin visit.

    At di end of voting, di number of unused ballot papers wey Inec officials cancel for some polling units plenti pass di number of ballot papers wey dey inside ballot box.

    BBC News Pidgin also see cases of vote buying for some locations across di state.

    For some polling units, voters collect 2,000 Naira while some collect as much as 12,000 Naira.

  6. Who go win Anambra govnorship election?

    Collage pictures of di top candidates

    Voting don officially close for di Saturday November 8 govnorship election for Anambra state, south-east Nigeria and citizens now dey await di result.

    Ova 2.8 million registered voters bin dey expected to cast dia ballot for dis election.

    16 candidates from different political parties go head to head for di number one seat for di state.

    Di incumbent Govnor Prof. Charles Soludo of di All Progressives Grand Alliance (APGA) dey seek re-election.

    Polls bin open across di 21 local govment areas of di state around 8:30am and close officially by 2:30pm.

    Na di Independent National Electoral Commission, Inec, go call di result and announce di winner of di poll.

    Dis na di first election for di new Inec chairman, Prof. Joash Amupitan.

    More on dis tori dey hia: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjw98zpl2j7o

  7. Sorting don begin as voting officially end for some polling units

    Voting don end for some polling units for Anambra State and officials don begin dey sort di electoral materials.

    For Polling unit 004, Ebeakpu ward 2, Awka South, sorting don begin.

    Voting officially end by 2:30pm and sorting go begin immediately, followed by counting.

    Foto as dem dey sort di votes for one polling unit for Awka South
    Wetin we call dis foto, Foto as dem dey sort di votes for polling unit for Awka South
    Vote sorting dey go on for dis polling unit for Awka South
    Wetin we call dis foto, Vote sorting dey go on for dis polling unit for Awka South
    Foto as dem dey sort votes for one polling unit for Awka South
    Wetin we call dis foto, Foto as dem dey sort di votes for one polling unit for Awka South
    Foto as dem dey sort di votes for Awka South for Anambra state
    Wetin we call dis foto, Foto as dem dey sort di votes for Awka South for Anambra state
    Foto as dem dey sort di votes for Awka South for Anambra state
    Wetin we call dis foto, Foto as dem dey sort di votes for Awka South for Anambra state
  8. 'My victory dey sure' - Govnor Charles Soludo speak after voting, Soludo accuse opposition of vote buying

    Foto of Charles Soludo s im arrive to cast im vote as di flagbearer of APGA
    Wetin we call dis foto, Foto of Anambra State Govnor, Charles Soludo as im arrive to cast im vote for Ofiyi Square, Isuofia, Aguata LGA.

    Anambra State Govnor, Charles Soludo don tok say im dey certain say im party All Progressives Grand Alliance (APGA) go win di gubernatorial election.

    Di flagbearer of di party, Soludo tell tori pipo afta im cast im vote for im polling unit say even if di opposition party dey share 100,000 naira to buy votes, im dey certain say if dem count di votes, im go win wit "landslide"

    Soludo cast im vote afta im arrive for im polling unit for Ofiyi Square, Isuofia, Aguata LGA of di state.

    Di incumbent govnor tok say di elections in di state dey peaceful, while im accuse opposition party of buying votes for 50,000 naira.

    "E dey peaceful and e dey go peaceful. E get reports for some polling for Olumbanasa wia BVAS no dey work, but e dey go on smoothly," e tok.

    "Concerns wey we dey receive na for Nnewi South LGA wia we understand say dem dey buy votes massively.

    One of di candidates from dat local govment wey dey desperate to win di local govment dey share 50,000 naira to voters and I tok say even if dem share 100,000 naira, make di pipo just vote. Count di votes na wetin mata for us and we dey convince say on di basis of di vote we go win wit landslide." E tok.

    "Now as for di process, e dey seamless and di crowd dey vote but in di next one hour voting go close. I expect say all dis pipo go vote."

    Pipo bin hail am wen e show up to vote and security pipo also dey ground to guide di place.

  9. AAC govnorship candidate allege vote buying

    AAC govnorship candidate for di Anambra election Chioma Ifemeludike don also accuse di ruling APGA party of voting buying.

    For video she post ontop her X account, she say wetin dey hapun no be election but transaction.

    "Dis na criminal, totally absurd!!! If APGA claim to get all di popularity why dem dem dey buy votes?" She ask.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  10. Breaking, Govnor Charles Soludo cast im vote

    Govnor Charles Soludo dey cast im vote
    Wetin we call dis foto, Foto of Govnor Charles Soludo as im dey cast im vote

    Anambra State Govnor, Charles Soludo of di All Progressives Grand Alliance (APGA) don cast im vote.

    E vote for PU 002, Ofiyi Square, Isuofia, Aguata LGA In Anambra State.

  11. Ihiala, Ogbaru and Ayamelum LGA dey peaceful - Police

    Anambra State Police Command

    Di Anambra State Police Command don give report say di govnorship election dey go on peacefully for Ihiala, Ogbaru, Ayamelum local govment areas.

    Dis local govments wey dem mention na part of di hotspots wia violence bin dey occur bifor, but di police say dem dey secure evri part of di state.

    According to Anambra police tok tok pesin SP Ikenga Tochukwu, e say di police dey neutral and dem go protect di integrity of di electoral process.

    “Police operatives and personnel of sister security agencies dey on ground across polling centres, collation zones, waterways, and border communities to stop any form of disruption and to provide confidence for voters to exercise dia civic responsibility witout fear or intimidation.”

    Do police add say dia men also stand gidigba for waterways to protect pipo wey gatz pass through di water to vote.

  12. APC candidate Nicholas Ukachukwu speak on election as e cast im vote

    Nicholas Ukachukwu don cast im vote
    Wetin we call dis foto, Foto of Nicholas Ukachukwu as im dey cast im vote

    Di govnorship candidate of di All Progressive Party (APC), Nicholas Ukachukwu for Anambra State, don accuse di rulling party, All Progressives Grand Alliance (APGA) of vote buying afta im cast im vote.

    E tok afta voting for Polling Unit 11, Ward 002 for Nnewi South LG, Anambra State.

    "Vote buying don become di biggest menace, wey go shut di kontri down. Becos wen pipo get to power dem no go need to do anytin again," e tok.

    "My observation be say from one of di places wey my pipo don visit na di issue of vote buying. Na bad tin and dem need to stop am.

    No be only about who, na about di party, APGA. E dey hapun for all polling units.

    "I believe say winning dey possible." E add.

  13. 'You dey sell your future by selling your vote' - Peter Obi, Peter Obi don cast im vote

    Peter Obi at di ongoing gubernatorial elections

    Wia dis foto come from, Screengrab/BBC

    Wetin we call dis foto, Foto of Peter Obi as im dey follow tori pipo tok afta im cast im vote for Umudimakasi Agulu, Anambra State.

    Peter Obi, di Presidential Candidate for di Labour party during di 2023 presidential election don accuse members of di opposition party of buying votes during di Anambra gubernatorial elections.

    E tok say e dey dissapointed say victims of bad governance na dem dey fuel am becos dem dey sell dia votes and dia future away.

    Obi tok dis afta im don cast im vote for polling unit 19 Ward 002 for Umudimakasi Agulu, Anambra State.

    "E be like say democracy dey kontinu to drop for our kontri. Unfortunately pipo wey be di victim of bad governace dey fuel am. I don listen around on wetin dey happun wetin you go see na vote buying," e tok.

    "For young pesin wey dey unemployed, if im sell im vote for 30,000 naira. Wetin dem go pay am next month wen e no vote? By selling your votes you dey sell no school, no job, you dey sell away your future."

  14. ‘I dey worried’ - LP govnorship candidate George Moghalu tok afta e vote,

    LP govnorship candidate George Moghalu tok afta e vote

    Wia dis foto come from, George Moghalu/Facebook

    Wetin we call dis foto, George Moghalu

    Di Labour Party govnorship candidate, George Moghalu, don cast im vote but express worry about wetin go be di outcome of di election.

    Moghalu bin cast im vote for Uruagu community, polling unit 017, Nnewi North for Anambra state.

    Afta e cast im vote, e say good voter turnout dey but di pipo no still get confidence for di election process.

    “I no know about free and fair, if you monetise di process, if you monetise poverty, wetin be free and fair election.

    “Good voters turn out dey, no doubt. Dat don be problem for some time but we don tok say e dey on Inec to dey improve for dia process becos voter apathy na becos pipo don lose confidence.”

    Wen Moghalu dey address di press pipo, e say na only Inec fit make di voters get confidence for di election process.

    E add say im dey worried say pipo no go fit express diasef for any process wey no dey trustworthy and dem no go come out to vote.

    “If pipo vote no count, why dem go wan waste dia time, if Inec and security do wetin dem suppose do, pipo go get confidence to come out to vote.”

    “I dey worry, no be about me, no be my ambition, na di process wey go make pipo express diasef.”

  15. Roadblocks full town as restriction take effect

    Roadblocks full town as Anambra State Police Command announce total restriction of vehicle movements in and out of Anambra State.

    Di restriction start since midnight and e go reach 6pm today bifor e go end.

    According to di tok tok pesin for Anambra police, SP Ikenga Tochukwu, dis na ‘unanimous decision wey dem reach for di meeting of di Security Services Commanders for Anambra State to prevent di movement of political thugs and oda criminal elements wey wan attempt to disrupt di electoral process.’

  16. 80-year-old woman wey don dey vote since 1963

    80-year-old woman wey don dey vote since 1963

    80-years-old Madam Ogochukwu, from Utuh community in Nnewi South don dey vote since 1963.

    She come out again to vote today.

    Madam Ogochukwu say she dey happy to come out to exercise her right.

    Di octogenarian come out to di polling unit even early pass young voters.

  17. Heavy security, late arrival of election officials for di election

    Police officers dey monitor election

    Wia dis foto come from, Anambra State Police Command

    Some polling units dey witness presence of heavy security for dis Anambra govnorship election.

    For some places, election officials bin come late and according to journalists wey monitor di situation, na logistics problem bin cause am.

    Meanwhile, some areas for Anambra East dey experience issues wit activating di BVAs machine and dat one cause delay small.

    Security officials dey patrol different wards and polling for di state.

    Di presiding officers too dey educate di voters on how dem suppose place dia finger for di ballot papers.

    For Polling Unit 006 Obi Palace, Umumunna Amakwa, Ozubulu Ward 01, for Ekwusigo LGA, voters bin queue up to follow cast dia votes while security personnel dey on ground.

  18. Voting begin for Anambra govnorship election

    Inec officials dey accredit old voter

    Voting don start for some local govments areas of Anambra State.

    For polling unit 6 Amawbia ward 2 for Awka South LGA, voting don start as voters bin queue to first do dia accreditation bifor dem begin vote.

    For dis election, security teams dey gidigba for di polling units to watch and secure di election materials.

    Pipo line up to vote
    Man dey vote for Anambra

    Wia dis foto come from, Credit: BBC

    Wetin we call dis foto, Voters begin to cast dia ballot
  19. Live from Amawbia

    We dey live for Amawbia, Anambra State as di govnorship election dey kick off.

    You fit also get live updates for our Facebook page.

  20. Join di BBC News Pidgin WhatsApp channel

    WhatsApp logo

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Join di BBC News Pidgin WhatsApp channel to get live updates of all di tori dem as e dey happun.

    BBC Pidgin WhatsApp channel bar code
    Wetin we call dis foto, Scan di bar code to join di BBC News Pidgin WhatsApp channel