Di candidates wey dey run for Anambra govnorship election 2025

Collage pictures of the main candidates

Wia dis foto come from, SOLUDO/UKACHUKWU/EZENWAFOR/MOGHALU/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Candidates for di Anambra govnorship election
Read am in 6 mins

Di race for who go be di next govnor of Anambra state for southeast Nigeria don reach. Di election go take place on Saturday November 8, 2025.

Na a total of 16 pipo dey drag dis number one post for di state, including di sitting Govnor Chukwuma Soludo wey dey contest for im second term.

Security teams don land di state, candidates don join hands sign peace accord ahead of election day.

Dis na tins you need to know about di candidates wey dey contest for di election.

Charles Soludo (APGA)

Chukwuma Soludo

Wia dis foto come from, CHUKWUMA SOLUDO/ FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Govnor Chukwuma Soludo

Chukwuma Charles Soludo na di fifth democratically elected govnor of Anambra state. E day run for second term for office.

Govnor Soludo, stand as di sole candidate of APGA during di party primary as nobody challenge am.

Chukwuma Soludo na former economist and banker wey rise to become govnor of Nigeria Central Bank before e join politics. E bin also serve as di chairman board of directors of CBN.

Soludo serve as chief economic adviser to former President Olusegun Obasanjo for 2003 and also serve as member of di presidential economic advisory committee under former President Muhammadu Buhari. E serve as chief executive of di National Planning Commission of Nigeria.

Di govnor na professor of economics and school for top schools like University of Nigeria Nsukka, University of Cambridge, Brookings Institution, University of Warwick, and University of Oxford and serve as visiting professor Swarthmore College (USA).

Dem born di govnor for 1960. Im from Isuofia for Aguata Local Govment Area of di state. E dey married to Nonye Soludo and dem get six children.

For 2009, Soludo announce say e wan become govnor of Anambra State under di PDP. E take am about 12 years to see dat dream come true. E bin lose against former Govnor Peter Obi for di 2010 govnorship election. E resign from di PDP for 2013 and join APGA, but di APGA Screening Committee disqualify am from contesting dat year govnorship election.

E win di 2021 govnorship election for Anambra State under APGA and remain for di party since den. Im first tenure as govnor start for March 2022 as e replace former govnor Willie Obiano.

Presently, im be di only govnor for Nigeria wey day elected under di APGA party.

Dr Nicholas Ukachukwu (APC)

Nicholas Ukachukwu wear red cap and black cloth

Wia dis foto come from, NICHOLAS/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Nicholas Ukachukwu

Nicholas Ukachukwu na di govnorship candidate of di All Progressives Congress.

Ukachukwu bin defeat top members of national ruling party like Valentine Ozigbo, Johnbosco Onunkwo and Edozie Madu to grab di ticket.

Di APC candidate from Osumenyi for Nnewi South Local Government Area, Anambra State

Dem born am for March 20, 1967.

Na top business man wey dey into oil and gas, real estate and agriculture plus media. Na im get di European University of Nigeria plus Oda businesses.

E get im first degree in Business Administration from University of Calabar and get honorary doctorate degree from Tensian University Anambra State.

E contest and win as di Member representing Abuja Municipal Area Council AMAC from 1999 to 2003. E contest 2003 senatorial election for Anambra South senatorial zone.

For 2006, e contest di Anambra govnorship election under di Hope Democratic Party but no win, e also contest di 2019 senatorial election for Anambra South under di APGA party.

E bin don serve as LGA chairman for Abuja.

Im first wife Nnenna Ukachukwu die for motor accident for 2020. For December 2023, e remarry Mitchel Ihezue wey be former Miss Universe Nigeria (2023).

Dr George Moghalu (Labour Party)

George Moghalu (Labour Party)

Wia dis foto come from, GEORGE/MOGHALU/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, George Moghalu

Dr George Moghalu na Labour Party candidate for di Anambra state Govnornship election.

Im be former managing director of the National Inland Waterways Authority (NIWA).

Moghalu emerge LP flag-bearer wit a total of 575 votes from di delegates wey attend di primary election wey hold for Finotel Hotel for Awka, di state capital.

Im na founding member of di All Progressive Congress APC but later switch to Labour Party.

George Moghalu bin don contest govnorship elections for di state under di APC but no win for primaries.

63 years old Moghalu come from di Nnewi North Local Govment Area of Anambra State.

E day married to Mrs Onyinyechi Moghalu and dem get five children. E school for Institute of Management and Technology IMT Enugu wia e get HND.

Moghalu na Fellow of Institute of Sales Executives FISA, Registered Practitioner of Advertising RPA, Member of Nigeria Institute of Management (MNIM), Fellow Institute of Corporate Administration of Nigeria ( FICA).

E also be Member of Nigeria Institute of public Relations (MNIPR), Fellow, Institute of project Managers of Nigeria (FIPM) and Fellow, African Business School (FABS).

Jude Ezenwafor (PDP)

Jude Ezenwafor

Wia dis foto come from, JUDE/EZENWAFOR/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Jude Ezenwafor

Jude Ezenwafor emerge di winner of di Peoples Democratic Party, PDP, primary wey hold for April. Na only am purchase di 40 million Naira nomination form for di govnorship election for im party.

Di candidate na Abuja-based real estate developer and business man.

For im political career, e bin don hold di position of di Vice President, Nigerian Youth Congress.

Di 45 years old don work wit almost all di administration wey don lead Anambra State. E serve as Special Assistant to Govnor Chinwoke Mbadinuju, Personal Aide to Govnor Chris Ngige, Protocol Officer to Govnor Peter Obi and also serve as Senior Special Assistant to Govnor Willie Obiano.

For 2007, e contest as govnorship aspirant under di Labour Party, im be govnorship candidate under Labour Party for di 2021 govnorship election. E be former Senatorial Candidate under di PDP.

Jude Ezenwafor from Nnobi town for Idemili South Local Government Area of Anambra State.

Names and parties of oda candidates

Dis na names of di 16 pipo and 16 political parties wey follow dey contest to be govnor of di state.

  • Onyeeze Chidi Charles – Accord Party (A)
  • Nweke Ezechukwu Japhet – Action Alliance (AA)
  • Ifemeludike Chioma Grace – Africa Action Congress (AAC)
  • Nwosu Chima John – African Democratic Congress (ADC)
  • Nicholas Ukachukwu – All Progressives Congress (APC)
  • Soludo Charles Chukwuma – All Progressives Grand Alliance (APGA)
  • Otti Cyprain Echezona – Allied Peoples Movement (APM)
  • Nweke Chrispopher Chukwudubem – Action Peoples Party (APP)
  • Okeke Chika Jerry – Boot Party (BP)
  • Moghalu George Nnadubem Labour Party (LP)
  • Onyejegbu Geoffrey – New Nigeria Peoples Party (NNPP)
  • Ndidi Christy Olieh – National Rescue Movement (NRM)
  • Ezenwafor Jude – Peoples Democratic Party (PDP)
  • Chukwurah Vincent – Social Democratuc Party (SDP)
  • Chukwuma Paul Chukwuka – Young Progressives Party (YPP)
  • Ugwoji Uchenna Martin – Zenith Labour Party (ZLP)