'I go fight for my children' - Regina Daniels

Nollywood actor, and one prominent Nigerian lawmaker wife Regina Daniels don come out to speak for di first time inside one video she post for her verified Instagram page about di kasala wey dey hapun for her family.
Di mata first begin trend for October wit one viral video for social media wey show say all no dey well.
Senator Ned Nwoko don deny accuse of abuse against Regina Daniels.
Ned Nwoko bin sahaparly respond to di video to say Regina dey abuse drugs and tok say she must go for rehabilitation.
For di statement, di 64-year-old senator, tok say im no dey violent towards any of im wife but Regina bin move comot from house becos she wan get unrestricted access.
"Regina no always like dis. Her current battle wit drugs and alcohol abuse na di root of our problem," e tok.
"She must continue her rehabilitation program, or I fear for her life and safety.
"Now she don move to place wia she get unrestricted access to drugs. I get oda wives, and none go ever accuse me of violence."
Few days ago, Regina accuse police of arresting her broda ontop di mata.
But tins take anoda turn on Wednesday wen she publicly address clearly some of di issues.
"Finally some pipo go get video now wey dem go fit take mock me... My entire focus right now na to know wia my broda dey. Wia Sammy dey Ned!!!"
Regina also accuse di "highest authorities for di police force, or if not di highest wey say dia hands dey tied" she write.
"I no regret anytin. Na only me carry my leg enta but dis na di route wey I dey meant to take, no be my final destination!!"
'I go fight for my children'
Regina Daniels tok for di video say her family dey in 'turmoil'. She dey hope say last-last her family go come out of dis kasala sake of say dem stand gidigba for her back, and na dis support dey ginger her to record di video and speak up.
For di video she address her husband say, "I go fight for my children, Ned, I dey try to dey calm but I go fight for dem and I go take dem, I go train dem and I go raise dem wit or witout your support."
For inside di video she address Senator Ned Nwoko, di Nigerian lawmaker wey dey represent Delta North Senatorial District as her 'ex husband".
She tok for di video say, even though she feel like say she dey act feem as she dey record di video, na reality she dey like dis.
"I no go cry even though tins dey tough at di moment".
'I dey shame to tok say I bin fall in love'
Regina wey blow as a child actor also speak on an area of her relationship wey bin don dey always dey news - as she and her husband get a very big age gap between dem - say she bin fall in love and marry.
"I dey shame to tok say I fall in love, my mama warn me, my brodas warn me, evribody bin warn me.
Evribodi bin no gree make I marry am, I no marry out of greed, we [her family] bin no dey broke."
She question pipo wey dey tok say she bin marry her husband sake of money. "How much money una tink say man go give my mama to let me marry am?
She explain say dat time for night, she go dey para for evribody becos she insist say she must marry Ned.
"I bin go police station go report say my family no want make I marry di love of my life.
Regina say even though she bin fall in love dat time, even now, she still care and respect di senator.
Regina dey hold di position of Social Secretary for di Senators Wives' Association currently.
For some days now since di arrest of Regina broda break for social media. Regina and her family say dem no know wia im dey as dem dey call for im release.
Di BBC don reach out to to di police to confam di arrest and and why.
Regina Daniels profile
Regina Daniels na popular acctress for di Nollywood industry.
Regina start her career as child actress at di age of 7. She feature in her first movie for 2007 in di movie "Marriage in Sorrow".
Since den she don feature in ova 100 Nigerian movies including Miracle Child, Python Girl, Spider-Girl, Hanging Coffin, Jaja the Great, Queen Rebecca, among odas.
Regina Daniels marry Ned Nwoko at di age of 18. Dia marriage don reach six years and dem both get two pikin.
Regina na di youngest wife of Ned, and she dey popular as an actress in di Nigeria feem industry. Dem don nominate her for plenti awards and she don win some too.
Regina get five siblings, wey dey supportive of her career and she be Mass Communication graduate and recently she join di Senators Wives Association as dia social secretary.
Ned Nwoko profile
Sixty-four-year-old, Ned Nwoko na Nigerian politician, lawyer and philanthropist.
Ned Nwoko go University of Keele, Staffordshire, wia e bin get im first and second degree in law.
Afta e finish school for UK, dem call am to English Bar for Lincoln Inn, one of di four Inns of Court for London.
Ned Nwoko start im career as lawyer for United Kingdom, wia e gada experience bifor e come back Naija to do politics and business.
For 1995, dem recognise am as di Best Black Lawyer of African Descent for England, for im success in di England legal field.
After e make am well for im legal career for United Kingdom, Nwoko return back to Nigeria for 1998.
E enta politics for 1999 and serve as House of Representatives member, e represent Aniocha/Oshimili Federal Constituency of Delta State from (1999–2003)
Ned na still active politician and e be sitting senator wey dey represent Delta North Senatorial District.









