All di court cases wey Senator Natasha Akpoti-Uduaghan dey face

Wia dis foto come from, Natasha Akpoti Uduaghan/Godswill Akpabio/Facebook
Justice Idris Kutigi of di Federal High Court Abuja don order di Senate President of Nigeria, Godswill Akpabio to appear bifor am, sake of one defamation case wey Senator Natasha Akpoti-Uduaghan bin file against am.
Dis na just one out of di series of court cases wey involve Mrs Akpoti-Uduaghan, di suspended lawmaker wey dey represent Kogi Central Senatorial District for di National Assembly.
According to tori by local media, Justice Kutigi bin grant di lawyer of Mrs Akpoti-Uduaghan, Victor Giwa, permission to serve Akpabio wit di court proceedings thru substituted means, since di Senate president bin no show face for court on 7 May, 2025 wey di mata bin suppose start.
Di Judge order Akpabio to show face for di court on Monday, 9 June, 2025. Though e neva dey clear weda dis date go get head since di Nigeria goment don declare am as public holiday for di Muslim celebration of Eid-El-Kabir.
Since late February dis year wen di crisis start between di female lawmaker and di Senate president Akpabio, na so court cases dey pile up between di two. Some of dem na Mrs Akpoti-Uduaghan start am, di odas na either di Nigeria goment or Akpabio family start am.
Remember say Mrs Akpoti-Uduaghan dey accuse Akpabio of sexual harrasment, wey she claim say e happun several times including for Akpabio house and for di Senate premises. However, Akpabio don deny di allegations.
Here na list of dis court cases and wetin be di issues:
350 billion naira suit by Mrs Akpabio
Shortly afta Natasha Akpoti-Uduaghan accuse Akpabio of sexual harassment during one TV interview, Mrs Ekaette Akpabio, wife of di Senate president, call a press conference, wia she tok say she don sue Mrs Akpoti-Uduaghan for defamation against her husband.
End of Di one wey oda users dey read well well
Akpabio wife say she file two court cases - marked CV/814/25 and CV/816/25 - for di Federal High Court Abuja, and demand damages of 250 billion naira and 100 billion naira respectively.
She tok say di allegations against her husband don cause her and her children "emotional and psychological abuse", and e don make her family to dey live for constant fear of threat to dia lives.
She want make di court restrain Mrs Akpoti-Uduaghan from making defamatory statements against di Akpabio family, and for her to withdraw di allegations and tender "unconditional apology to di Senate president" wey go dey published for two national newspapers.
100 billion naira suit by Akpoti-Uduaghan
Natasha Akpoti-Uduaghan bin also file court case against Godswill Akpabio and im legislative aide, Mfon Patrick, wia she allege say di aide bin post one article on Facebook wey she say dey damaging to her reputation.
Di Kogi lawmaker ask di court to order di defendants to pay her 100 billion naira for damages and anoda 300 million naira in litigation costs.
Inside di suit, marked CV/737/25, Mrs Akpoti-Uduaghan say di post by Mfon Patrick dey "defamatory, provocative, and damaging to her reputation".
Oga Patrick bin make dis post afta di wahala wey happun for di Senate chambers on 21 February, 2025, wia Mrs Akpoti-Uduaghan bin para and shout for di Senate president afta dem change her sitting position.
Di incident wey show for national TV bin see di female lawmaker telling Akpabio say "I no dey afraid of you", "I don take a lot from you. I bin no wan go public, but if you want I go let Nigerians know how you don discriminate against me, how you dey malign me..."
Days later, oga Patrick den post di article on Facebook wit di title: "Shey di Local Content Committee of di Senate be Natasha Birthright?"
Di legislative aide say Mrs Akpoti-Uduaghan dey para becos di Senate President bin remove her as di chairman of dat Senate committee.
But di female lawmaker vex for di part wia Patrick say she no sabi anytin about being a legislator except to dey "pancake her face and dey wear transparent outfits to di chambers".
Dis remarks, she tok, "dey false and na to ridicule her, damage her credibility, and expose her to public contempt".
Natasha vs Senate, Akpabio, Senate committee

Wia dis foto come from, Natasha Akpoti-Uduaghan/Instagram
E also get anoda court case wey Senator Akpoti-Uduaghan file to challenge her six-month suspension from di Senate, afta a report by di Senate Committee on Ethics, Privileges, and Public Petitions.
Di committee bin recommend her suspension afta Mrs Akpoti-Uduaghan fail to appear bifor dem for investigation into her conduct for di Senate chambers on February 21.
Akpoti-Uduaghan hersef explain say she no attend dat investigation sake of say court bin don order di committee to postpone di hearing pending di determination of di mata bifor di court.
But di committee members say dem no dey bound by any court order since dem dey do dia work as independent arm of goment.
Dis mata on weda Mrs Akpoti-Uduaghan suspension dey valid or not, dey bifor Justice Binta Nyako of di Federal High Court Abuja.
AGF vs Natasha
Most recently, di office of di Attorney General of di Federation file anoda court case for di Federal Capital Territory High Court, sake of allegations of defamation against di Senate President Godswill Akpabio and di former govnor of Kogi State, Yahaya Bello.
For di three-count charges wey di goment bring against di female lawmaker, dem say Mrs Akpoti-Uduahan bin claim say Akpabio and Bello bin get plans to kill her, and say dis allegation na lie.
According to di AGF, Mrs Akpoti-Uduaghan know or she suppose know say "dis imputations go harm di reputation of Senator Godswill Akpabio, President of di 10th Senate of di Federal Republic of Nigeria, and di reputation of Yahaya Adoza Bello, former govnor of Kogi State".
Di witnesses wey di FG say dem go call for dis mata include Akpabio, Bello and one senator identified as Asuquo Ekpenyong plus three oda pipo.
Dis mata suppose start on Tuesday, 3 June, 2025, but e no kon go ahead becos of strike wey di Judiciary Staff Union of Nigeria (Jusun) bin start di previous day.
E neva dey clear wen di new date go be.














