Why Mohbad no go ever visit hospital - Wife give more testimonies

Mohbad wife tok more tins about late afrobeats star

Wia dis foto come from, MohBad/Instagram

Di wife of late singer Ilerioluwa Oladimeji Aloba wey pipo sabi as Mohbad don reveal reason why her husband no ever go hospital wen im get injury for hand.

Dis na sake of how many pipo dey question why she no quickly carry am go hospital.

Wunmi Aloba appear for court on Tuesday for di coroner inquest sitting wey dey look into di cause of death of her husband.

She tell di Inquest say e get reason why her husband hate to dey go hospital afta im don face many threat issues from im former label.

Wunmi tok say di whole fear begin from wen Mohbad make attempt to comot di record label and di time wen officers of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin carry am and oda record signees.

Mohbad tell me say dem give am one white substance to drink

Wia dis foto come from, X/@iammohbad_

Wetin we call dis foto, Dem admit Mohbad for October 2022

‘Dem hit Mohbad head wit gun and give am substance to drink’

“E tell me say dem hit gun for im head and im no get imsef since dat time, ” wife of di late singer tell court.

Di 24-year-old wife speak on all di oppressors wey dey threanten im husband bifor e die. She also reveal how dia relationship bin begin from secondary school reach wen dem bin do traditional marriage.

Wunmi narrate di ordeal wia men of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) arrest Mohbad.

“Dat day we receive call say NDLEA don dey house dey arrest pipo. My husband just shout say im brothers (referring to Zinoleesky and Adura Aloba) dey house and e quickly rush go di house.”

“Na di house wey Naira Marley collect for all di signees wey dey under Marlian music na im NDLEA come burst.”

She reveal say dem beat her husband as e dey question why dem come burst dia apartment. Di incident bin happun for February 2022.

“Dem don handcuff Zinoleesky and my husband dey ask di officers wetin di pipo do but dem become violent. Dem dey beat my husband and I dey ask dem why dem dey beat am.

“Dem bin wan leave di estate but di gatemen no allow dem, na so di NDLEA officers begin dey shoot gun for up. Dem beat me fall for gutter till my wig comot for my head and dem carry my husband and odas comot,” Wunmi tok as tears begin dey roll down her eyes for di witness box.

Di wife of di deceased add say de release her husband for night and im beg say make dem carry am go hospital sake of say dem give am one white substance to drink.

“E tell me say dem give am one white substance to drink and truly I see white tin for im mouth wen im come back. My husband say na only am dem give di substance bifor dem release am.

“I see one deep cut for im head wen we reach hospital, wen I ask am wetin happun. E tell me say dem hit am gun for head wey give am di mark for head,” Wunmi add.

Wunmi expose say na since dat time her husband begin dey forget tins and im no dey imsef again since di incident happun.

“Since dat time, im no trust any hospital again becos dem begin dey threaten am. IM oppressor get connection everywia and dem fit pay anyone.”

Mohbad wife, mother and brother appear for court
Wetin we call dis foto, Mohbad wife, mother and brother appear for court

‘Mohbad comot Marlian music wit zero account'

For her testimony, Wunmi tok how di journey of Mohbad wit Marlian music bin begin and wetin occur wit di boss Naira Marley.

Wunmi wey tok say na for over ten years she don sabi her husband, reveal say Mohbad don begin dey try do well for imsef before im even sign for record label.

“Wen I meet am, im be rapper and me I be rapper too from secondary school. Im join one popular challenge for social media wey BaddyOsha bin organise and e win.”

“One day im tell me say Naira Marley message am for Instagram say make dem link up. I advice am say make e just feature Naira Marley for one song, make e never sign any deal but Mohbad say di signing go help im career.”

Wunmi reveal say she no know Naira Marley from anywhere until Mohbad begin dey tok about am and e dey trend dat time but tins begin dey fall apart wen dem no gree make im change im manager.

“Mohbad bin wan change im manager becos Tunde (Naira Marley cousin) wey dey manage am no dey do anytin. But di record label boss tok say na dem go choose who go be manager for am.”

“Im begin dey see different threats. Im oppressor dey bully am and im no dey stable again for 2022 wey im comot di label. Na zero account im comot di label wit, e no get anything to start and im begin dey struggle to survive.

'Aside Olamide and Bella Shmurda, some artistes avoid Mohbad'

For her testimony, Wunmi tell di court say her husband 'oppressor' dey use different means to dey threaten am.

Wen she dey narrate how her husband dey survive wen im comot Marlian music, Wunmi say na very difficult time as pipo no wan follow her husband relate again.

She reveal say Mohbad bin try reach out to some oda artistes but dem no reply.

"E reach out to some artistes but dem no wan relate wit am, aside Olamide and Bella Shmurda. Im oppressor fit pay anyone to harm my husband and e dey live for fear till im death."

"Bella Shmurda bin feed us for about three months wen all di wahala dey happun becos we no get anytin." She tok.

She tok say her husband bin vomit for toilet after di nurse shook am injection.

Wunmi Aloba wey be di wife of di deceased appear for court on Tuesday during di coroner inquest.

She reveal say her husband begin dey complain afta di nurse give am injection for inside di room and im go toilet go vomit.