Wetin be coroner inquest wey Lagos state judiciary wan adopt for MohBad death

Late Afrobeat star Ilerioluwa Aloba aka Mohbad

Wia dis foto come from, MohBad/Instagram

Lagos state judiciary don set date wey dem go commence coroner inquest into di strange death of late Afrobeat star Ilerioluwa Aloba aka Mohbad.

Na for one reply letter wey coroner magistrate T A Shotobi bin sign on Tuesday e reveal say dem go begin inquest wey go expose di facts wey dey surround di death of Mohbad.

Inquest na judicial inquiry wey go help ascertain di facts wey surround any incident while coroner na judicial official wey get di power to conduct investigation or inquest into wetin cause di death of pesin.

Wetin inquest go do na to answer questions on how suspicious death bin happen.

BBC Pidgin follow ogbonge lawyer Festus Ogun tok about how dem go conduct di coroner inquest into di death of Mohbad and wetin go happun next.

Oga Ogun say dis particular death of Mohbad dey strange and na why dem go conduct an inquest.

Im also explain wetin coroner inquest mean and why e dey necessary.

“A coroner na judicial system wey make enquiry or investigation into di circumstances surrounding di death of a person in di event say di death no dey natural.”

Lagos go begin di preliminary inquiries into di death of Mohbad

Wia dis foto come from, X/@mrfetsusogun

Wetin we call dis foto, Lawyer Festus Ogun

Procedures and who go participate

Following di decision of di Lagos state judicial to conduct an inquest into di death of Mohbad, di ogbonge lwayer wey we follow tok reveal doz wey go participate for di process.

According to di ogbonge lawyer Ogun, all di pipo wey dey involved bifor di death and afta di death of Mohbad go appear for di process. Im tok say since wey na investigation, evri stakeholder wey get information to share go dey invited for di inquest.

“Dem go invite many pipo since say na investigation. Di coroner (Judge) no go enta street dey look for facts by imsef. E go look into facts from doz wey dey involved and stakeholders go relay information.”

E add say “di coroner go check di information wey pipo provide and im go come up wit report.”

While e dey tok about di process, di lawyer reveal say na investigation and even doctors and pathologist wey dey involved for di autopsy go appear during di inquest. Dem go ask dem questions wey helep lead to how di truth go come out.

“Dem go invite everybody wey dey involved including di family members and medical persons. Now wey dem don do autopsy, di pathologists and oda doctors go offer assistance,” lawyer Ogun tell BBC Pidgin.

Coroner no get power to punish

As plenty pipo dey clamour for di results of di autopsy wey dem do ontop Mohbad death, odas go also dey look for wetin di result of di coroner inquest go be.

However, Ogun confam say di coroner no get di power to pronounce anybody guilty. E add say na only di attorney-general fit prosecute after im don look all di evidences wey dem go present give am.

"E dey important to note say di coroner no get di power to punish or pronounce guilty.:

"Na to just investigate di cause of di death and afta dat, di attorney-general go come decide if one person dey guilty or not. Di attorney-general go prosecute".

Di Lagos state judiciary don set Friday 29 September as date wey dem go begin di preliminary inquiries into di death of Mohbad and e no suppose take long according to wetin sabi pipo tok.

Mohbad don die bifor dem reach our facility - Lagos hospital wash dia hand comot

Investigations into di death of late Afrobeat star Ilerioluwa Aloba aka Mohbad still dey go on.

Five days afta di Nigerian police dig out im deadi body and conduct autopsy di result neva come out.

Autopsy, aka post-mortem exam, na one special surgical procedure wey dem dey use sabi di cause and how pesin take die.

Cause of death na di medical reason wey dey explain why one patient pass.

Di latest update na from di hospital wey carry Mohbad body go drop for mortuary.

Perez Medcare Hospital wey dey for Lekki area of Lagos, Southwest Nigeria issue ogbonge statement on Monday wia dem remove dia sef from any tin wey concern Mohbad death.

Dem reveal say contrary to wetin many pipo dey tink, pipo wey carry Mohbad come dia facility carry am come as pesin wey don already die.

For statement wey di management of di hospital sign, dem also say dem no even get chance to treat di artist becos dem categorize am as BID (Brought in Dead).

Mohbad death at di age of 27 on 12 September, 2023 na one wey shake di kontri and wey don generate a lot of interest.

Wetin really cause di death of late Mohbad neva still clear.

Screen grab of Perez Hospital reaction

Wia dis foto come from, Perez Hospital/Instagram

Wetin we call dis foto, Screen grab of Perez Hospital reaction

However, Perez hospital say dem sef get interest to sabi wetin kill di young artist.

Dem explain say video wey dey go around wey late Mohbad dey ontop bed no be dia hospital be dat – di nurse wey also take care of di artist bifor dem come di hospital, no be Perez hospital staff.

“We consider am important to put am on record say at about 04:30pm on di 12th of September 2023, dem bring di lifeless body of Mr Ilerioluwa Oladimeji Aloba (aka Mohbad) to our medical facility.

“Our medical team immediately go into action and afta assessment, discover say e no get sign of life, no central or peripheral pulse, no heartbeat, no recordable vital signs and im eye no dey move and e just dey open.

“On attempting CPR (Cardiopulmonary Resuscitation), rigor mortis (dem observe say some part of im body don dey hard sake of day e don die) abd we tell di pipo wey carry am come our facility say na case of BID (Brought in dead).

“Upon enquiry about di circumstances wey lead to di emergency, dem tell our team say na one nurse bin dey treat am for house and she bin don give am injections,” di statement tok.

No mago-mago for dis case - Police

Di Lagos state police command don give update on dia investigation on di death of di Afrobeats star, Mohbad.

Tok-tok pesin for di command Benhamin Hundeyin tok say make pipo relax as wayo no dey for di investigation of di case.

“As we dey wait di result of di autopsy, we want make everybody calm down and dey confident for di process. Underhand dealing no dey di mata as some concerned pipo dey fear.”

On top di autopsy, Hundeyin say na some of di best forensic pathologists for di kontri carry out di autopsy for di presence of family members

E give assurance say oda aspects of di investigation also dey progress well-well.

Police give update on Mohbad investigation

Wia dis foto come from, Benjamin Hundeyin/Twitter

Social media users drag pastor

Pastor Tunde Bakare of Citadel Global Community Church
Wetin we call dis foto, Pastor Tunde Bakare

Some Nigerians dey drag Pastor Tunde Bakare afta e call di late musician Mohbad out and im name.

E tok dis one for message say while e no blame Mohbad, di name no be good name.

Although pipo fit interprete di name - Mohbad - for Yoruba to mean I dey bad, however for one interview, di singer explain how e get di name.

E say pesin bin tell am say e ‘bad’ sake of how e good wit music but e later reason am and e come up wit di name Mohbad to mean say - Moh Bright And Destined - wey mean I dey bright and destined.

Di pastor claim say di late Afrobeat star live wetin e call “unpleasant lifestyle” – e also ask im worshippers if “Mohbad na good name.”

Reactions to pastor Bakare comment

Wia dis foto come from, BBC Pidgin Facebook

Wetin we call dis foto, Reactions to pastor Bakare comment
FFK response to Bakare

Wia dis foto come from, Femi Fani-Kayode/X

Wetin we call dis foto, FFK response to Bakare
Reactions to pastor Bakare comment

Wia dis foto come from, BBC Pidgin Facebook