You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why Trump wan deport migrants to Nigeria plus oda third kontris - and if e do am?
Nigeria don accuse di US of pressuring African kontris to take in Venezuelan deportees.
Di West African kontri minister of foreign affairs Yusuf Tuggur on Channels TV on Thursday, 10 July claim say, di US goment dey pressure Nigeria to accept 300 Venezuelan deportees into di kontri, as e suggest say di recent visa restrictions on Nigerian travellers by di US no be "reciprocal" but pressure tactic.
"Di US dey mount considerable pressure on African kontris to accept Venezuelans wey dem wan deport from di US, some of dem na straight out of prison," Foreign Minister Yusuf Tuggar tok.
Dis dey come as international media report say Oga Trump on Wednesday, 9 July ask di presidents of Liberia, Senegal, Guinea-Bissau, Mauritania and Gabon wey dey for US for official visits to take in illegal migrants from oda kontris.
Oga Tuggar don tok say Nigeria "no go be dumping ground for Venezuelan prisoners deported from di US".
"We get enough problems of our own; we no fit accept Venezuelan deportees to Nigeria. We already get 230 million pipo," e tok.
Earlier dis week, di US Department of State tok say part of a "global reciprocity realignment", nearly all non-immigrant and non-diplomatic visas dem dey issue to citizens of Nigeria, Ghana, Cameroon and Ethiopia, go now be single-entry and valid for only three months.
Why Oga Trump dey deport migrants from di US go third kontris
One cornerstone of US President Donald Trump immigration policy na to remove unlawful migrants comot di kontri plus di promise of "mass deportations".
And since e take office on 20 January, Oga Trump don announce plenty immigration-related executive orders, wey give way for widespread effort to crack down on undocumented migrants for di US.
In more dan 21 actions, Trump don move to overhaul parts of di US immigration system, wey include how dem dey process and deport migrants from di US.
According to one New York Times review of U.S. government documents, di administration don ask and dem dey plan to ask nearly sixty kontris to take deportees wey no be dia citizens.
Many of these kontris, most of which be Africa, dey subject to one new full or partial travel ban to di United States, or dem dey considered for one.
Reports also say Oga Trump bin ask di five African presidents, di presidents of Liberia, Senegal, Guinea-Bissau, Mauritania and Gabon – wey dey America for official visits – to take in illegal migrants from oda kontris.
US Solicitor General John Sauer say di goment no dey fit deport violent criminal migrants go dia homelands as those kontris dey refuse to accept dem, which e say allow dem to stay for di US "victimising law-abiding Americans".
Di US get right to deport migrants go third kontris?
For June, US Supreme Court bin clear way for President Donald Trump administration to resume deportations of migrants to oda kontris wey no be dia own kontri.
By 6-3, di justices bin reverse one lower court order wey require di govment to give migrants "meaningful opportunity" to tell officials di risks dem fit face if dem deport dem go third kontri.
Di case bin involve eight migrants from Myanmar, South Sudan, Cuba, Mexico, Laos and Vietnam, wey dem deport for May on one plane wey dey go for South Sudan. Di Trump administration bin tok say dem be "di worst of di worst".
Di Supreme Court bin allow Trump to end Temporary Protected Status for Venezuelan nationals, wey affect about 350,000 migrants.
For anoda ruling for May, di justices say di president fit temporarily pause one humanitarian programme wey allow nearly half a million migrants from Cuba, Haiti, Nicaragua and Venezuela to stay for di US for two years.
Di Department of Homeland Security (DHS) for statement say wit dis decision, DHS go finally fit exercise dia undisputed authority to deport criminal illegal aliens–wey dia home kontri reject go third countries wey don agree to accept dem.
Third kontris US dey reason to send deportees go and di once wey don accept deported migrants
Nigeria
Nigeria goment don confam say dem dey face pressure from US to accept deported migrants from Venezuela. Di kontri foreign minister Yusuf Tuggar wey announce dis informate tok say Nigeria get "enough problems" of dia own and no go host foreign prisoners from di US.
Di minister add say Nigeria no go bow to pressure from di Trump administration to accept Venezuelan deportees from America.
Liberia
According to reports, Liberia fit dey consider US proposal to accept pipo wey di America deport, including criminals. Reports say Liberia wey get close historical links to America, dey part of one proposed list of kontris wey di US don appraoch.
South Sudan
South Sudan bin take in eight convicted deportees from di US on 5 July, but only one was South Sudanese. Di rest of dem na citizens of Myanmar, Cuba, Vietnam, Laos and Mexico.
Pipo see di decision as attempt to soothe Washington sake of di punitive travel restrictions dem impose afta Juba refuse to receive South Sudanese deported from di US.
Rwanda
Rwanda goment and Trump administration dey discuss details about a potential agreement for Kigali to accept deportees from di U.S. wey include Africans and oda non-Rwandan nationals, BBC partner for US CBS News learn.
Decisions on potential financial compensation for taking in di deportees plus oda details still dey ground according to one Rwandan official, wey confam am to CBS News.
CBS News report say one US official and one Rwandan official don confam say active toks dey about sending third-country deportees from America go di east African nation.
During one televised Cabinet meeting event for May, Secretary of State Marco Rubio bin say dem dey actively look for oda kontris to take in migrants expelled from di US.
Na Washington Post bin first report di Rwanda arrangements, wey also cite one work by independent journalist Marisa Kabas, she bin discover one recent deportation of one Iraqi national from di US to Rwanda.
Costa Rica
For February, Costa Rica bin announce say dem go receive migrants from oda kontris wey di United States dey deport afta one deal wey di two kontris strike.
"Di Government of Costa Rica don agree to collabo wit di United States in di repatriation of 200 illegal immigrants to dia kontri," di Costa Rican president office bin tok for statement, and add say "these pipo originate from ... Central Asia and India."
Among di deportees na more dan 80 children, di Costa Rica goment bin shelter dem for di Temporary Migrant Care Centre (Catem), south of di capital, San José.
Panama
For February 2025, di Trump administration bin deport non-Panamanian migrants from US custody to Panama.
Dem bin deport more dan 200 migrants from India, China, Uzbekistan, Iran, Vietnam, Turkey, Nepal, Pakistan, Afghanistan and Sri Lanka go di kontri.
According to one MOU wey di two kontris sign, di US goment go provide approximately $14 million give di government of Panama to deport or expel illegal migrants wey no get legal grounds to remain for dia kontri.