You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Make una reconsider' - How goment react to US three month single entry visa policy for Nigerians
Nigerian goment don react to di recent development by di United States Department of State wey review di visa policy for Nigeria passport holders.
Tok-tok pesin for ministry of foreign affairs, Kimiebi Imomotimi Ebienfa tok say di kontris don get long standing relationship and dis new policy go place burden on Nigerian travellers wey dey go United States.
Nigerian goment say US make dem reconsider dia visa policy restriction in order to maintain di partnership, cooperation, and shared global responsibilities between both kontris and dia citizens.
"Nigeria note say dis restriction place disproportionate burden on Nigerian travellers, students wey dey seek academic opportunities, professionals engaging in legitimate business, families wey dey visit dia loved ones and individuals wey dey contribute to cultural and educational exchanges," di statement tok.
"While acknowledging di sovereign right of every kontri to determine dia immigration policies, Nigeria respectfully beg di United States to reconsider dis decision in di spirit of partnership, cooperation, and share global responsibilities.
"Diplomatic engagements dey go on, and di Ministry of Foreign Affairs remain committed to pursuing resolution wey dey reflect fairness and uphold di value of mutual interest."
United States Department of State on Tuesday announce new update to dia reciprocal non-immigrant visa policy, wey go affect many kontris including Nigeria.
Di new change to di US Visa Reciprocity Policy for Nigeria, wey go begin wit immediate effect, go affect non-immigrant and non-diplomatic visas.
From now, any Nigeria citizen wey wan apply for visa go only get single entry wey go last for just three months.
Inside statement wey di US Embassy and Consulate in Nigeria post for dia website on Tuesday, dem say all non-immigrant visas wey dem bin issue before 8 July 2025 go retain dia status and validity.
Di move na based on US reciprocity principle to match evri visa terms wey kontris set for dia kontri pipo wen dem apply for visa.
Di embassy say visa reciprocity na di standard for di world, and na continuous process and diafore dis decision dey subject to review and change anytime.
" We wish to emphasis say, as par standard, visa reciprocity na continuous process and e dey subject to review and change at any time, like increasing or decreasing permitted entries and duration of validity," di embassy tok.
As part of visa reciprocity policy, kontris fit to increase or reduce permitted entries and duration of validity.
US say, "U.S. visa criteria and standards dey designed to protect di integrity of U.S. immigration systems."