Cameroon say opposition leader Issa Tchiroma go face di law over election unrest

Read am in 4 mins

Cameroon Interior Minister Paul Atanga Nji say opposition leader Issa Tchiroma Bakary go face legal action on top accuse say e ginger "violent post-election demonstrations".

At least four protesters die during clashes between security forces and opposition supporters afta Cameroon election on 12 October. Di protests increase afta di Constitutional Council declare 92-year-old President Paul Biya winner of di election.

Tchiroma Bakary insist say na im win di election, claim wey Biya ruling party, di Cameroon People's Democratic Movement (CPDM) don dismiss.

For im reaction to di declaration of Biya as president for di eight consecutive term, Tchiroma say di electoral institution don "turn away from dia mission as guardian of truth and democracy to bicom a partisan body, enemy of di sovereignty of di pipo."

"Yet di truth of di ballot dey clear. Di official reports from our polling stations, wey our representatives across di kontri compile and secure, show say we win dis election by a large majority," e bin tok.

Di way wey police and security officers take violently clampdown on protesters don alarm di international community, as UN, African Union and EU call for restraint.

On Tuesday, 28 October, Nji bin accuse Tchiroma Bakary say e organise wetin e call "illegal" protests wey lead to di loss of lives, e also criticise am for declaring victory for di election.

E add say Tchiroma Bakary "supporters wey dey responsible for di insurrectionary plan" go also face legal action.

President Paul Biya, wey enta power for 1982 and wey now be di world oldest head of state, win di 12 October election wit 53.7% of di vote, compared to 35.2% for Tchiroma Bakary, according to Cameroon Constitutional Council.

Tchiroma Bakary neva respond to di govment decision to prosecute am, but e bin tell BBC bifor say im no go accept stolen vote – plus say im no dey fear arrest.

E also demand immediate end to di arrest and intimidation of pipo wey dey protests.

"Setting a kontri ablaze and drenched in blood just bicos you wan cling to power no only dey morally wrong: na crime against di pipo and against humanity" E tok.

On election result day, e say armed men bin open fire on protesters wey gada near im house for Garoua, wey seriously injure at least two civilians.

On Tuesday, di interior minister tok say dem go launch investigation into violent incidents bifor and afta di announcement of di election results.

"During dis attacks, some of di criminals lost dia lives," e tok, without providing specific number of protesters wey die for di clashes.

Nji bin add say several members of di security forces also sustain serious injuries.

Although Nji claim say di situation nationwide now dey under control, protesters still dey active for some parts of di kontri, especially for Douala and Garoua, wia demonstrators bin mount roadblocks on Tuesday, and burn tyres for streets.

Analysts warn say di post-electoral violence fit put di kontri into political crisis.

One Cameroon opposition leader Maurice Kamto wey di electoral commission disqualify from contesting for di election sake of say two parties field am for di election neva react to di result.

Kontri pipo bin see Oga Kamto wey come second for di 2018 presidential election, as potential strong challenger to di incumbent President Paul Biya.

However, afta di election as protests dey burst across di capital, Kamto for one post on im official account call on di constitutional council to respect di verdict of di ballot box.

E say e dey important make official results correspond to di choice wey Cameroonian voters make in good conscience for di ballot box.

"Those wey dey threaten public order na those wey dey seek to change di outcome of di ballot box, no be di oda way around," e tok.