Tinubu pick Shettima as running mate for APC - Dis na wetin we know

"Tinubu running mate": "Kashim Ibrahim Shettima" and "Bola Ahmed Tinubu" Muslim-Muslim ticket

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Kashim Ibrahim Shettima serve as director general of Bola Tinubu Campaign Organization until June wen im team win di APC Presidential primaries.

Bola Ahmed Tinubu don pick Kashim Ibrahim Shettima as running mate for Nigeria 2023 presidential election.

Dis na as "Ibrahim Masari don withdraw as Tinubu running mate for next year election."

Tinubu advisor tell BBC Pidgin on Sunday say di man wey im name bin dey di place holder wey dem submit to Nigeria election agency, Inec, don withdraw.

Tunde Rahman confirm di tori as video wey show di ruling APC presidential candidate inside President Muhammdu Buhari home town don go viral.

Tinubu name Kashim Ibrahim Shettima as Masari replacement, inside di video, and BBC Pidgin fit independently verify di statement now.

"I never discuss wit am, I don disclose am to you" Tinubu tell reporters for Daura.

President Buhari office don confirm say Tinubu don notify am of Shettima selection as running mate.

Bola Ahmed Tinubu campaign organization don acknowledge Masari resignation as di APC vice presidential candidate.

"I no dey Daura wit Tinubu, but I know say Masari don withdraw and we don accept im resignation."

Oga Rahman say if Tinubu name Kashim Shettima as im running mate then e fit be true as e be say di pesin wey bin dey di place holder don comot.

Tori be say Masari inside one letter addressed to members of APC on Sunday, announce say im dey quit di role.

For Daura, Buhari village inside Katsina State for northwest Nigeria, Tinubu, tell reporters about im choice afta a close-door meeting wit di president, reports tok.

Inside di video, di former Lagos state govnor say Shettima dey selected because im dey “competent, capable, reliable and able to be picked as a running mate”.

Kashim Ibrahim Shettima na former Borno State govnor.

At di time of dis tori, Shettima never tok ontop di mata.

E serve as director general of Bola Tinubu Campaign Organization until June wen im team win di APC Presidential primaries.

If Shettima accept di offer, then e go be say na Muslim-Muslim ticket di APC party dey field for next year Nigeria presidential poll.

Na sake of say Kashim Shettima na Muslim just as Bola Tinubu be of same faith.

Tori be say many dey argue say as e be say na kontri wey get two main religions - Christian and Muslim, e go make sense make political parties choose like dat.

Di last time a major political party presidential flagbearers be all Muslim na weh MKO Abiola and Babagana Kingibe contest di annuled June 12, 1993 election.

Kashim Ibrahim Shettima profile

"Tinubu running mate": "Kashim Ibrahim Shettima" and "Bola Ahmed Tinubu" Muslim-Muslim ticket

Wia dis foto come from, AUDU ALI MARTE

Wetin we call dis foto, Kashim Ibrahim Shettima be govnor of Borno State wen Boko Haram kidnap di Chibok Girls for April 2014.

Kashim Ibrahim Shettima na Nigerian banker and politician wey don serve as a Senator for Borno Central Senatorial district since 2019.

Shettima bin serve as di govnor of Borno State for northeast Nigeria from 2011 to 2019.

Im be son of Govnor of Northern Nigeria Kashim Ibrahim wen Nigeria bin dey run regional goment.

Shettima graduate from di University of Maiduguri and di University of Ibadan.

Afta school, im enter business and banking, and im later gbab several executive positions for banks.

For di mid-2000s, Shettima become di manager of Zenith Bank Maiduguri office before im comot di position to enta di state cabinet of Governor Ali Modu Sheriff for 2007.

"Tinubu running mate": "Kashim Ibrahim Shettima" and "Bola Ahmed Tinubu" Muslim-Muslim ticket

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Tinubu win APC Presidential primary for June 2022.

Afta e spend four years for di cabinet, im win election to become di govnor of Borno for 2011 and e gbab re-election for 2015.

Shettima later enta di upper legislative house for Nigeria through election to become Senator of di federal republic of Nigeria for 2019.

Dem born Kashim Shettima for Maiduguri, for di capital of Borno.

Im be member of di family of Alhaji Shettima Mustafa Kuttayibe.

Afta school, im enter business and banking, and im later get oda executive positions for banks.

For di mid-2000s, Shettima become di manager of Zenith Bank Maiduguri office before im comot di position to enta Governor Ali Modu Sheriff cabinet for 2007.

Afta e spend four years for di cabinet, im win election to become di govnor of Borno for 2011 and e gbab re-election for 2015.

Shettima later enta di upper legislative house for Nigeria through election to become Senator of di federal republic of Nigeria for 2019. 

Bola Ahmed Tinubu profile

"Tinubu running mate": "Kashim Ibrahim Shettima" and "Bola Ahmed Tinubu" Muslim-Muslim ticket

Wia dis foto come from, BAT

Wetin we call dis foto, Bola Ahmed Tinubu dey populalry known as Jagaban

Bola Ahmed Tinubu na one of di most respected politicians for Nigeria.

Tinubu get popular title - Jagaban of Borgu.

Di politician get reputation as a godfather wey dey use im power and influence to support im candidates.

Im win di kontri ruling All Progressives Congress presidential ticket to contest di 2023 election.

Nigeria President Muhammadu Buhari describe am as one of di pipo wey work to create and develop di APC to di political party e be now.

Di politician na di former govnor of Lagos state for western Nigeria.

Im political career start as far back as 1992, when e join di Social Democratic Party.

Fo sdp im be member of di Peoples Front faction wey Shehu Musa Yar'Adua lead.

Im later enter di Senate, to represent di Lagos West senatorial district for di short-lived Nigerian Third Republic.

Afta dem cancel di results of di 12 June 1993 presidential elections.

Tinubu become founding member of di pro-democracy National Democratic Coalition [NADECO]

Dat na one group wey mobilize support for di restoration of democracy and recognition of Moshood Abiola as winner of di 12 June election.

Tinubu dey married to Oluremi Tinubu, a Nigerian senator and e get children.