‘If I die today dem go put me inside’ - Man wey dey build ‘Makara’
- Author, Mansur Abubakar
- Role, Journalist
- Reporting from, BBC
For di past 45 years na only business Kano based Auwalu Salisu get and na to dey make di tin wey Muslims dey use carry deadi body go burial ground.
As Muslims no dey bury inside coffin na Makara dem dey use carry deadbodi go cemetery.
Makara na di Hausa language name and na bamboo stick dem dey take use make am.
According to 68 year old Auwalu im business dey remind am of death evri day even though e dey stop some odas from visiting am.
“E get pipo wey dey feel say if dem get anything to do wit me dem go die becos of Makara wey I dey do.
“And e get some wey even if dem dey pass my side dem no dey gree look wia I dey keep Makara for fear of death.
“Wetin dem dey forget na say death go visit everybody if you look or no look makara.”
“As for me if I die today na inside dem go put me carry me go cemetery, I think of dat daily as I dey do my work.”
According, to Auwalu na skill wey fit die as many young pipo nowadays no gree learn how to make am.
As dem prefer to go chase businesses wey dem feel go bring big money.
“I learn am 45 years ago from my family and since den I dey do am.”
Di man explain say different types of makara dey depending on di pesin dem wan use am for.
“We get for children and older people and also short or tall pesin.”
Di price dey range from N10,000 to N20,000 depending di type pesin wan buy.

Video by: Monday Idara






