You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Who be di judges for South Africa genocide case against Israel for di International Court of Justice?
Fifteen judges for di International Court of Justice (ICJ) go consider South Africa case against Israel on charges say Israel commit genocide against Palestinian civilians during di war for Gaza.
According to ICJ rules, any kontri wey be party to a case and no get judge of dia nationality on di bench fit nominate a special judge.
Dis na di case for both Israel and South Africa.
Israel don select Aharon Barak, di former chief justice of di kontri Supreme Court, who don express support for Israel war against Gaza.
British lawyer Malcolm Shaw – wey dey considered to be one of di world foremost experts for international law - go also defend Israel for di ICJ.
South Africa Judge na Dikgang Moseneke. E be di former Supreme Court Deputy Chief Justice and e bin get ogbonge legal and academic career both for South Africa and abroad.
International law professor, John Dugard, go also represent South Africa for di ICJ case. E be former human rights rapporteur for di United Nations and don previously serve as judge for di ICJ.
Chief Justice Joan Donoghue
Joan Donoghue na US lawyer and legal scholar. She be di current president of di ICJ.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem first elect her to di Court for 2010 and dem re-elect her for 2014.
For 2021, fellow judges of di ICJ bin elect Chief Justice Donoghue to serve as di president.
She be di third woman to dey elected to di ICJ and di first American woman dem go elect as president.
Chief Justice Donoghue don serve as advisor to former US President Barack Obama and former Secretary of State Hillary Clinton and on all aspects of international law.
Vice President Kirill Gevorgyan
Dem elect Judge Gevorgyan as member of di ICJ in February 2015, and e becaome vice-president for February 2021.
E don hold di position of legal officer for Russia foreign affairs ministry since 2009.
E don represent Russia before di ICJ for several cases - most notably na one case wey Georgia bring ova Russia violations of di Convention on di Elimination of All Forms of Racial Discrimination for 2008.
Judge Abdulqawi Ahmed Yusuf
Judge Youssef na Somali national and e hold doctorate for political science and international law from di University of Geneva.
Dem first elect am to di ICJ for 2009 and dem re-elect am in between 2018 and 2021. He serve as a special judge for inside one case wey dem bring to di ICJ by Djibouti against France about mutual assistance for criminal cases.
Judge Julia Sebutinde
Born in Uganda for 1954, dem first elect Judge Sibutende as a member of di ICJ for 2012 and dem re-elect am for 2021.
She hold honorary doctorate for law from di University of Edinburgh for UK. She bin previously hold several judicial and legal positions, as she dey serve as judge for di Special Court for Sierra Leone from 2005 to 2011.
She don handle several war crimes trials, including di case against Liberian President Charles Taylor, wey chop accuse of committing war crimes and crimes against humanity during im presidency.
Judge Patrick Lipton Robinson
Dem born Judge Robinson for Jamaica in 1944 and e don be member of di ICJ since 2015.
E work as legal advisor to Jamaica ministry of foreign affairs and for 26 years e be di kontri representative to di Sixth Legal Committee of di United Nations General Assembly.
E play leadership role on several provisions of di Committee, including di definition of aggression and di draft statute of di International Criminal Court.