Portugal vs Nigeria- All you need know

Portugal vs Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigeria men national football team go play Portugal for international friendly match dis week.

Dis match dey come few days before di start of di Fifa World Cup in Qatar.

Super Eagles no dey go World Cup but Portugal dey go.

Di European team dey di same group wit Ghana, Uruguay and South Korea for di tournament.

Di match na Portugal last build up game ahead of di big football tournament for Middle East.

Dis game dey come afta di ogbonge interview wey Cristiano Ronaldo do wit Piers Morgan wia im accuse Manchester United of betrayal and oda tins.

Dis Na wetin you need know about di international friendly game.

Wen Portugal dey play Nigeria?

Di international friendly game between Portugal and Nigeria go take place on Thursday November 17.

What time be Portugal vs Nigeria match?

Di International friendly match go begin by 7:45pm Nigeria time dat na 6:45pm for Portugal.

Nigeria team news

Nigeria invite 23 players for dis friendly match against Portugal

But head coach Jose Peseiro don replace Victor Osimhen wit Cyriel Dessers and Chidozie Awaziem come in for Olisah Ndah.

Im replace dem sake of Injury.

Goalkeepers: Maduka Okoye, Francis Uzoho, Adebayo Adeleye

Defenders: William Ekong, Olisa Ndah, Calvin Bassey, Kevin Akpoguma, Chidiebube Duru, Tyronne Ebuehi, Bruno Onyemaechi, Bright Osayi Samuel

Midfielders: Joseph Ayodele-Aribo, Alex Iwobi, Wilfred Ndidi, Frank Onyeka, Oghenekaro Etebo

Forwards: Moses Simon, Samuel Chukwueze, Ademola Lookman, Terem Moffi, Paul Onuachu and Emmanuel Dennis

Portugal team news

Goalkeepers: Diogo Costa, Jose Sa, Rui Patricio

Defenders: Diogo Dalot, Joao Cancelo, Danilo Pereira, Pepe, Ruben Dias, Antonio Silva, Nuno Mendes, Raphael Guerreiro

Portugal team news

Goalkeepers: Diogo Costa, Jose Sa, Rui Patricio

Defenders: Diogo Dalot, Joao Cancelo, Danilo Pereira, Pepe, Ruben Dias, Antonio Silva, Nuno Mendes, Raphael Guerreiro

Midfielders: Joao Palhinha, Ruben Neves, Bernardo Silva, Bruno Fernandes, Joao Mario, Matheus Nunes, Otavio Monteiro, Vitinha, William Carvalho

Forwards: Andre Silva, Cristiano Ronaldo, Goncalo Ramos, Joao Felix, Rafael Leao, Ricardo Horta

How to watch Portugal vs Nigeria

SuperSports go show di Portugal vs Nigeria match live for Nigeria.