How to check JAMB 2024 UTME results

Jamb Portal

Wia dis foto come from, Jamb/Web

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don release di results of di 2024 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).

Jamb registrar, Prof. Ishaq Oloyede give di informate for one conference for Abuja, Nigeria capital on Monday.

Di examination wey start on Friday, 19 April end on Monday, 29 April 2024. E hold for 118 examination towns and for 774 centres.

A total of 1,989,668 candidates register for di UTME, di exam wey go guarantee dem access into higher education.

1,904,189 million candidates sit for di exam. Meanwhile di board release di results of 1,842, 464 candidates.

According to di Jamb registrar, 64, 624 results still dey under investigation for different reasons.

Di breakdown of di results wey Jamb tok say dey under investigation include;

  • Under Investigation on Verification (2, 896 results)
  • Procedural Investigation of Candidates (4, 594 results)
  • Centre Based Investigation (57, 056 results) for 18 Centres: 12 for Edo state, 3 for Akwa Ibom, 2 for Delta and 1 for Kwara state.
  • Alleged Examination Misconduct (78)

Breakdown of student’s performance for di 2024 UTME

Jamb say out of di 1,842,464 results wey di examination body release, 0.4% score above 300 while 24% score 50% (200/400) and above.

8,401 candidates score 300 and above. 77,070 score 250 and above. 439,974 candidates score 200 and above while 1,402,490 candidates score below 200.

How to check UTME result

Di board don advise candidates to use di phone numbers wey dem take register to text UTMERESULT to 55019/66019.

Dem say dem no need to go any CBT centre or cybercafé to check results.

Jamb also explain once di candidate send di text, candidate wey get result go receive di message:

Those results wey dem still dey process and di ones wey dey absent go receive “under processing” and “absent” respectively, di exam board add.

Those under investigation go receive:

  • Verification Investigation
  • Under Investigation (A)
  • Under Investigation (B)
  • Alleged Infraction

Who be Jamb highest scorer

Di Joint Admission Matriculation Board no announce di name of any candidate as di highest-performer for di 2024 UTME.

Jamb registrar say e no dey in dia nature to announce any candidate as di best-performing candidate as dem consider UTME only as a ranking examination for candidates wey dey seek admission to tertiary institutions.

Di board say to avoid repetition of di Mmesome saga - one girl wey claim say she get di highest score for Jamb, wey pipo and top organizations begin send am awards and gifts.

Jamb don beg pipo wey wan award prizes to candidates wey perform well-well for di exam to always verify from dem bifor dem go ahead.

Di Board add say di reason why dem no dey name highest-scorer na becos of di different variables institutions dey adopt plus candidate wey score di highest mark fit still no get admission into university.

“Hence, e fit dey unrealistic or presumptive to say a particular candidate na di highest scorer sake of di fact say di candidate for di final analysis, fit no even dey admitted.”